You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Salisu Yusuf video: Nigerians don begin react to recording wia Super Eagles coach collect money
Read am in 1 mins
Shock, vex and 'na lie', na so Nigerians dey take react to video wey show as Super Eagles chief coach Salisu Yusuf dey collect money from undercover tori pipo.
Na Ghana tori pesin Anas Anas do di video wey BBC Africa Eye don broadcast.
For di video, Salisu collect $1000 from Anas pipo wey pretend say dem be players agents, to make am cari two players go di African Nations Championship, wey happun last year.
Salisu don deny say im do anytin wrong and say na $750 im collect from di pipo.
Dis na how pipo take react for twitter: