World Cup 2018: First gold, Second silver, Third bronze, England wetin?

Read am in 1 mins

E no dey come home, at all at all.

Belgium no pity England small for di World Cup third-place match to cari bronze.

Dis go be di kontri best finishing for any World Cup competition.

Na Thomas Meunier scata di Three Lions net wit di first goal for di fourth minute den Eden Harazd cement victory for Belgium wit goal for di 82nd minute.

But as England players go dey cry small smal say dem no win, some fans don tok wetin di kontri go cari wit dia new position.

BBC Pidgin bin post foto to ask wetin dem go England and na so we start to dey see tins wey just dem make us say whaaaaat.

Some of di tins wey dem tok be:

  • Grass
  • Aluminium plate (as in di pesin say all na shine shine)
  • Wood
  • Paper
  • Plastic
  • Komkom milk

Well, you fit go we Facebook page wey dey below to join your comment.