Nigeria vs Iceland: Super Eagles coach say im sabi di best formation

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Fiona Equere
- Role, BBC News Pidgin
- Read am in 1 mins
Nigeria pipo don wait tire to watch di Super Eagles battle Our Boys of Iceland on Friday for dia second group D World Cup match.
Di 4pm match go decide weda Nigeria, wey tanda for di bottom of di Group D, fit progress or ...begin book flight back to di kontri
Nigeria coach Gernot Rohr don tok say im sabi di best formation to play Iceland today even as plenti people dey criticise am.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Nigeria bin loose 2-0 to Croatia for dia first match of di 2018 FIFA World Cup on Saturday 16 June for Kaliningrad stadium.
Fans say di formation wey Mr Rohr use for di match no work at all.
Nigeria go play dia second group D match against Iceland on Friday for Volgograd Arena.
Mr Rohr tok say dem don watch di Croatia match again to make sure say dem no do di same mistake again.
"We go dey more professional wit our defending, especially rom set-pieces."
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Di team need at least one point for dat match to get any chance to make am to second round.

















