Kwesi Nyantakyi don resign as Ghana FA President afta FIFA ban

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
When strong breeze blow big tree dey fall for ground, Kwesi Nyantakyi don finally announce say im don resign as Ghana Football Association Presido and FIFA council member.
Nyatankyi resign Friday afta FIFA ban am for 90 days on top investigate feem wey implicate am.
FIFA first announce imi ban Friday afternoon as part of reply to 'Number 12' video investigative reporter Anas Aremeyaw Anas release dis week wey show how football ogas and referees dey collect money, according to statement from FIFA Ethics Committee chiarmo Vassilos Skouris.
FIFA add say for di period wey dem ban Nyantakyi, "im no suppose take part in any football activity for both national and international level (administrative, sports or any oda)" and di ban come into forve immediately.
Dem fit extend di ban reach anoda 45 days.

Wia dis foto come from, CARL DE SOUZA
On Thursday Ghana President, Akufo-Addo bin sack all Ghana Football Association (GFA) members on top dis Anas expose; 'Number 12' video.







