2018 FA Cup: Chelsea beat Manchester United 1-0 for Wembley final

Chelsea bin loose to Arsenal for 2017 FA Cup final

Wia dis foto come from, Getty Images

Chelsea don win di 2018 FA Cup afta dem beat Manchester United for Wembley

Na Belgian Eden Hazard score di only goal wen im beat David de Gea for penalty.

Na Manchester United defender Phil Jones tackle Hazard for inside 18 yard box wey make referee Michael Oliver award penalty.

Pogba and Smalling

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Manchester United players no win any trophy dis season

United sef try but Chelsea goalkeeper Thibaut Courtois no allow dem score.

For di whole of di first half United attackers no worry Chelsea defence dem no even fire one shot give Chelsea goal Keeper Thibaut Courtoius

E mean say Chelsea finish di season wit trophy for dia pocket.

Na di second time wey dem go play FA Cup final back-to-back. For 2017, dem loose to Arsenal.

Di blues finish fifth for league wey mean say dem no play Champions League next season.

Di FA Cup na di first domestic trophy wey Italian Antonio Conte go win for England

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Antonio Conte future still neva clear for Chelsea

Nobodi know wetin go happen to Chelsea coach Antonio Conte as tori wey dey circulate be say e fit leave di club soon.

But at least e good say im don win trophy for dem.