Emmanuel Boateng end Barca unbeaten run for La Liga plus record hat-trick

Emmanuel Boateng

Wia dis foto come from, BIEL ALINO

Wetin we call dis foto, Emmanuel Boateng score three goals
Read am in 1 mins

Ghana striker Emmanuel Boateng score Barcelona hat-trick to end dema unbeaten run for di La Liga season, dis be di second hat-trick against Barca since 2005.

Boateng en hat-trick be di first of en career as en club lowly Levante finish Barcelona 5-4 for di Estadi Ciutat de València on Sunday.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Reports be say dem invite Boateng make he come play give Black Stars friendly against Iceland den Japan.

Boateng become di first player to net hat-trick against Barcelona in La Liga since Diego Forlan in 2005.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Di hosts, Levante lead di game 5-1, Emmanuel Boateng score three goals den en colleague Enis Bardhi also net two goals.

Barca dema Philippe Coutinho score hat-trick, wey Luis Suarez convert penealty for di final game which unfortunately end Barca demma unbeaten run in 44 games.