Afcon 2019: Dem don thief di artificial grass for Cameroon stadium

Wia dis foto come from, GABRIEL BOUYS
E be like film trick but e don happen.
All di grass wey dey for di Cameroon Douala Stadium don find new owner.
Thief comot di 160, 000 square foot artificial grass for di stadium even as di country dey arrange am for di 2019 Africa Cup of Nations (AFCON).
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Local tori come show say na so 'okada' people come dey carry am dey sell for black market.
Dem build di Douala Stadium for 1972 and e suppose be di place where some of di 2019 AFCON matches for happen.
Cameroon don dey get suffer-head make dem arrange ground for di AFCON competition, and if dem no take time, CAF fit comot dem as di host.







