Nigeria: Kano Pillars defender Chinedu Udoji die for motor accident

Wia dis foto come from, Chindeu Udoji/Facebook
Kano Pillars football Chinedu Udoji, don die for road accident.
Di media officer for di team, Idris Rilwanu Malikawa Garu, tell tori people say di accident happen for Sunday night around Independent Way for inside di Bompai area of di state capital, Kano.
Garu say: ''Udoji motor jam concrete for di roundabout as im dey go house for Badawa Quarters after im go visit im former Enyimba teammates for dia hotel''.
Na only Udoji dey inside di motor wen e get accident.
Udoji, wey dey play for central defence, dey di Kano Pillars league match against Enyimba football club wey dem play 1-1 for di Sani Abacha Stadium, Kano.
Di Pillars bin say dem dey process all di paper wey dem go need to carry im deadi-bodi go village for im burial.
Udoji waka comot leave wife and two pickin dem.






