African U-23 cycling cup: Na Eritrean win first lap

Contestants for di African U-23 cycling race, Cameroon

Wia dis foto come from, Vivendi Sport

Wetin we call dis foto, Mebrhatom Natnael from Eritrea na im win di first lap of di competition on 1 February

Na 90 riders di compete for win dis first edition for U-23 African Cycling Cup weh e start 31 January for Douala, Cameroon dia economic capital.

Eritrean Mebrhatom Natnael win de first lap, as e pedal 92km for 2'25:13 hours inside Douala. Dis na e first trophy, but e be bi best climber for Ruanda dia race.

Mebrhatom di wear yellow jersey dis morning, as de race go start for Idenau for Southwest region for kam Douala.

Riders for di African U-23 Cycling cup

Wia dis foto come from, Vivendi Sports

Wetin we call dis foto, Riders dey continue di races dem, for di five-day event

Tomorrow, Yaoundé and Akono population go live de race and na for Sunday de winner go show after e go pedal 417km.

Na de first taim Africa di host U-23 cycling race and na International Cycling Union, UCI e partner and Cameroon Cycling Federation di organise de cup.