You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Olivier Giroud don join Chelsea
Read am in 1 mins
Olivier Giroud don join Chelsea from Arsenal.
Di French striker wey play for Arsenal on Tuesday night against Swansea, cross road join London rivals Chelsea for money wey reach £18m for 18 months.
Giroud say: "Chelsea na one of di biggest teams for Premier League. Dem don win maybe di trophy wey plenty pass in di last six or seven years. Dem be big club and I dey proud to sign for Chelsea, and I dey look forward to play."