"Na me tell Wenger to allow Iwobi play" - Rohr

Arsenal midfielder Alex Iwobi dey play ball

Wia dis foto come from, Getty Images

Technical Adviser for di Nigeria Super Eagles, Gernot Rohr, say di relationship wey im get with coaches dem go allow players dey ready for di 2018 World Cup wey go happen for Russia dis year.

Mr Rohr say na im tell Arsene Wnger to still dey play Alex Iwobi, even after di wahala wey di player bin get for di club.

Apart from di friendlies wey dem don arrange, Rohr talk say good make Nigerian players dey play well-well for dia club to show say dem go fit play for Russia.

Arsne Wenger

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Arsenal's Alex Iwobi for chop punishment from im coach Arsene Wenger when im go party wey im no suppose go

Di technical adviser say dis na how im go know whether each and every player for di team dey fit.

Nigeria coach Gernot Rohr

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Nigerian Football Federation don give Nigeria coach Gernot Rohr another contract

Dis na as im talk say when dem go Russia, time go reach wey wives and girlfriends of players fit visit dem.

Tori before be say im wan ban wife and girlfriends dem from Super Eagles camp.