You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
FIFA Club World Cup 2017: Wetin you suppose know about di tournament
Wydad Athletic Club of Morocco go play for dia first FIFA Club World Cup wey go start 6 December for United Arab Emirates.
Wydad go join six other teams to compete for di title of di best club for di world.
Al Jazira, Auckland City, CF Pachuca, Gremio, Real Madrid and Urawa Red Diamonds na di other teams wey go show.
Di Club World Cup na international club football tournament between champion clubs from di six continental confederations, with di national league champion of di country wey dey host.
Dis na some interesting things about di Club World Cup for UAE
- Real Madrid na defending champions and if dem win am again, dem go be di first club for di history of di competition wey go win am back to back. If dem achieve am dem go join Barcelona as di most successful side for di history of di tournament with three wins.
- Na African referees go handle di opening match between Al Jazira (UAE) and Auckland City of New Zealand.
- Na two stadium dem go use for di tournament, di Zayed Sports City Stadium for Abu Dhabi and Hazza Bin Zayed Stadium for Al Ain.
- Na UAE get di tallest building for di world- di Burj Khalifa
See di matches wey go happen for di FIFA Club World Cup
Playoff-round- Dec 6
Al Jazira vs Auckland City
Quarter-finals - Dec 9
End of Di one wey oda users dey read well well
Pachuca vs Wydad Casablanca
Winner Match 1 vs Urawa Red Diamonds
Fifth-place play-off- Dec 12
Loser Match 2 vs Loser Match 3
Semi-finals- Dec 12
Gremio vs Winner Match 2
Winner Match 3 vs Real Madrid
Third-place play-off- Dec 16
Loser Match 5 vs Loser Match 6
Final-Dec 16
Winner Match 5 vs Winner Match 6
Na for 2000 dem play di first FIFA Club World Cup.