UCL: Ronaldo break record as Real Madrid hama Apoel

Wia dis foto come from, Getty Images
Champions Real Madrid flog Apoel Nicosia 6-0 for Cyprus to qualify for di Champions' League round of 16.
Karim Benzema and Cristiano Ronaldo score two goals each for di match. Ronaldo na di highest goal scorer for di competition with eight goals.
E be like say Ronaldo never tire to dey break record because di two goals wey im score mean say im don nack 18 for 2017.
Nobody don score reach dat amount for di competition for one year alone before.
For another match for Spain, Liverpool troway dia 3-0 lead for Sevilla to draw 3-3, di result mean say di Reds need one point against Spartak Moscow for di final group game to qualify.
Tottenham Hotspur don win dia group after dem come from behind to beat Borussia Dortmund 2-1 with goal from Harry Kane and Heung-Min Son. Pierre-Emerick Aubameyang na im score for Dortmund.

Wia dis foto come from, Reuters
Manchester City continue dia fine form dis season as dem beat Feyenoord to top dia group G while Napoli keep dia small hope alive as dem nack Shakhtar Donetsk 3-0
Newcomers Leipzig end Monaco hope to progress with two sharp goals just nine minutes after di match start.
End of Di one wey oda users dey read well well
Who don qualify for knockout stage?
Bayern München, Beşiktaş, Manchester City, Paris Saint-Germain, Real Madrid, Tottenham Hotspur.
Wednesday games
Group A: Basel v Manchester United, CSKA Moskva v Benfica
Group B: Paris Saint-Germain v Celtic, Anderlecht v Bayern München
Group C: Qarabağ v Chelsea, Atlético Madrid v Roma
Group D: Sporting CP v Olympiacos, Juventus v Barcelona










