Romelu Lukaku: Man Utd striker go pay US police to avoid jail sentence

Romelu Lukaku wey be Manchester United striker don avoid to go jail for United States after im agree to pay compensation money to Beverly Hills police.

Police bin arrest Lukaku for July after im neighbours make five different complain give police about noise for house im bin dey rent.

Lukaku go pay $450 to police as cost for di callouts.

Dat one go make dem reduce di charge from misdemeanour, wey fit make person spend up to six months for jail.

Instead, dem go charge Lukaku say im disturb peace, and dis one carry fine of $100 plus other costs and other punishment wey dey on top.

Di thing bin happen di week before Lukaku join Manchester United from Everton for £75m.

Dem go hear di case again for Los Angeles Airport Courthouse on 18 December.