Ibadan bank robbery: Police tok how armed robbers wey reach 10 attack bullion van for Oyo State

Wia dis foto come from, Tvc News
Police for Oyo State don confam say at least three pipo including two police officers die afta armed robbers wey reach 10 in number hijack bullion van around Idi-Ape area of Ibadan.
Police say di bullion van bin dey carry money when di armed robbers attack dem for di southwestern Nigerian town.
Di armed robbers engage di police officers wey dey escort di bullion van and in di process, dem carry undisclosed amount of money run.
Di Oyo State Commissioner of police, Ngozi Onadeko wey confam di robbery incident say two police officers bin suffer bullet wounds and dem later die for hospital.
Di Commissioner wey follow tori pipo tok wen she visit di scene also confam say one of di policemen bin shoot dead one of di armed robbers during di gun battle.

Wia dis foto come from, TVC News
During di shootout, bullet hit and kill one civilian passer-by for di scene. Four others including two police officers dey hospital and dey respond to treatment, according to police.
She also add say investigations still dey go on, she assure pipo say pipo wey get hand for di robbery attack go dey punished.
Meanwhile di state governor, Seyi Makinde don react to di robbery incident wey happen for Idi-ape area of Ibadan.
End of Di one wey oda users dey read well well
For inside tweet on im social media handle, di governor say dem dey grateful to those wey call 615 - di state response line - to report di incident.
E add say: "we go continue to improve our response times using di apparatus available to us at di state level.
"We remain grateful to all security officers wey continue to put dia lives on di line for us," im tok.
Oda similar robbery wey don happen
Osun robbery

Wia dis foto come from, File foto
Last year, robbers bin storm two towns inside Osun State wia dem hit two commercial banks.
Di robbers also attack a police station, inside di southwest state on Wednesday, 2 June, 2021.
Police don confirm di bank robbery dem and di attack on dia station by di robbers.
Tori be say di suspected robbers land a about 5.30- 6pm and begin shoot anyhow wey come cause great panic.
Di towns dem attack na Apomu, di headquarters of Isokan Local Goment Area and Ikire, headquarters of Irewole Local Goment Area. .
According to local report dem attack First Bank in Ikire and Access Bank inside Apomu.
Another report say di robbers first attack di Apomu bank before moving to Ikire, according to PM News wey quote wetin residents tok.
Di robbers enter Apomu and Ikire through Ikoyi town, and divide demselves into different groups before dem attack di police station.
And then hit di affected banks, one of which dey for Oke-Ola area.
Offa robbery

Wia dis foto come from, Nigeria Police Force
For April 2018, armed robbers bin attack banks for Offa local government of Kwara state, north central Nigeria.
Di robbery be one big incident wey claim more dan 30 lives dat time.
Police bin arrest five gang leaders and 17 oda suspect wey get hand for di attack and dem charge dem go court.












