'Pipo bin tink say I dey craze for Enugu'
Di need to build strong cars wey go last and no go comot for ground follow for wetin dey inspire me, na so di young innovator tok.
Amalu Kamso Chizoba, di young man wey recently trend for social media afta im sports car prototype show face for internet build motor wey e dey drive from scrap materials.
Di video attract plenty attention from Nigerians wey believe say Chizoba fit do more if e get better material to build sport cars.
I sabi all di dustbin for Enugu state
Di 21 year old say wen im dey grow up pipo dey see am as pesin wey dey crase,
"My papa sef bin support me because e no understand how I dey behave," e tok.
According to Chizoba e pipo know am as pesin wey dey enta wia dem dey throway dirty "but dem no understand wetin I dey do dia."
"Wen I dey Enugu pipo tink say my brain no correct becos den, I no get any friend. I dey always waka inside dustbin.
"I know almost all di dustib wey dey Enugu state and I dey waka am from morning till evening. Pipo wey see me for di dustbin dey tink say I dey mad.
Oda tins Chizoba don build
Di Enugu-born innovator say e don tey we e don dey wan create sometin wey make sense, "e be like say dem born me wit am", e tok.
E say as e dey grow up e bin dey use plastic to create some kain tins. E say e don tey wey di idea to build di motor dey im mind.
E continue wit im efforts and come even build one helicopter for 2013, build drone for 2018 and e first car wey e call Gravity for 2019.
Chizoba tell BBC pidgin say scrap materials wey im see and buy for junk yards and dustbins na im e take build im first car.
Di 21 years old add say because of di project wey im dey do, e no get any friend.

