Mummy GO trend: Exclusive interview wit Evangelist Olufunmilayo Adebayo
For some days now, 'Mummy G.O' don dey trend for Nigeria social media sake of her teachings and preaching inside short-short video clips and memes wey don go viral.
Inside di clips, one female pastor wey her name na Evangelist Olufunmilayo Adebayo don make comments wey some pipo no agree with while odas see am as source of comic relief.
BBC Pidgin sidon tok wit Evangelist Olufunmilayo wey don pass 50 years old about if true-true na she make those comments.
Evangelist Funmilayo tell BBC Pidgin say most of di videos and memes wey dey circulate no be di true picture of wetin she tok. She deny say she even tok some of dem.
'Footballers no go make heaven'
Di evangelist also dey quick to accept say she teach some of those tins wey go viral.
Like her teaching about women make-up wetin dem dey wear and even pipo wey dey play football.
"E get sometin wey we call modest, I don travel go many Muslim kontris, you no go see any of di Muslim women wear anytin wey go open dia body, even dia air hostess di way dem dress, you go know say dis pipo fear God.
"All dis tins I dey tok wey be like crime on social media, 50 years ago, anybody wey be elderly pesin go support me, no woman fit enta church without covering head, di God wey no allow woman enter church dat time wey e no cover hair don travel or e don change?... becos I preach old message I don turn criminal."
As for football she say:
"Many pipo on social media dey tok about am, No be only me dey tok about am, google god of soccer you go see am, why I no tok about oda games? Wetin I tok about am wen I still belong to di oda side why dem no publish dat one? Dem just wan ginger pipo wey love soccer against me. Why I tok am, becos of events wey wan hapun very soon wey go introduce Anti-Christ into di whole world, e go come through di World Cup dats all," na wetin she claim,
"Some pipo say wetin I dey tok no dey inside bible, shey bible say make we no smoke, e no tok so but if your pastor carri Igbo dey smoke for pulpit dey preach say Jesus is coming, you go believe am? Why we dey against am and e no dey bible? Why you believe am? Sense of human make understand say some tins no dey right.
"Di only way to make heaven na to obey God," she add.
Interviewer: Helen Oyibo. Video Journalist: Gift Ufuoma

