European Super League football: Teams wey don pull out of ESL

Chelsea fans protest about the European Super League outside Stamford Bridge

Wia dis foto come from, Getty Images

European Super League football don hit rock as di big six Premier League clubs dem wey bin join 12 teams to form di competition don pull out.

Manchester City na dem first afta Chelsea bin say dem go leave too, then followed by Arsenal, Liverpool, Manchester United and Tottenham.

Di clubs for different statements tok say dem listen to wetin dia fans bin tok and na why dem withdraw.

Di League [ESL] say, "with how tins dey now, we go tink di next moves to make wey go make sense, as we dey keep our fans enjoyment for mind."

Uefa president Aleksander Ceferin say make di football community concentrate so how dem go fit rebuild di unity wey dem bin get before as di clubs don come back "to di fold".

Di European Super League bin dey planned as league wey go see di English football 'big six' plus six odas go dia own lane and to dey play matches for midweek.

Di oda teams include Atletico Madrid, Barcelona and Real Madrid from Spain and AC Milan, Inter Milan and Juventus from Italy.

Di move of di clubs don cause fans dem to vex sotay around one thousand of dem gada for Stanford Bridge during Chelsea game against Brighton on Tuesday to protest against di plan.

Even sef, football authorities and goment ministers for UK chook mouth for di mata.

In fact, some of di player for di big six like Liverpool's captain Jordan Henderson bin no like am sotay dem post for dia social media say dem no want di move to happun.

Now wey im be like say di dust don settle, calls don dey come in say make di club owners come beg for forgiveness on top wetin dem do football.