Cape Town fire: Rhodes memorial fire dey burn 'out of control' for South Africa

Read am in 2 mins

Wildfire wey don go 'out of control' dey burn for Table Mountain for Cape Town, South Africa.

Di wildfire wey dey burn for South Africa Table Mountain don force University of Cape Town to evacuate dia students from campus.

Di fire wey bin start around on past 8am South Africa time on Sunday, don burn many buildings for di campus.

"All UCT students don comot from campus," di university tok inside statement wey dem release.

Di Cape Town Fire and Rescue Services tok tok pesin, Jermine Carelse, tell local tori pipo say dem bin get alert of di fire around 8:45am South African time.

Earlier, Oga Carelse say dem immediately send firemen go di mountain side and dem still dey expect more fire-fighters to come join.

So far, one of di fire fighters don wunjure from di fire and e dey hospital dey receive treatment.

University of Cape Town na one of di best universities for Africa.

Cape Town authorities say dem dey "monitor" di situation and "staff go go door-to-door if dem need to evacuate."

Fire fighters don dey fight very hard since morning to control di fire as dey move dey burn buildings.

Di first building di fire burn na part of one restaurant, Rhodes Memorial.

Unconfam tori be say di fire start afta one big explosion wey happun for di Rhodes Memorial restaurant.

But official statement say di fire start near di restaurant for anoda part of di Table Mountain, before e begin sharply climb di mountain as e dey spread.

Oga Carelse add say dem get three helicopters wey dey water bomb di area - to try to quench di fire as dem dey use helicopter to release water from sky.

"Di fire currently dey out of control and we want make all di pipo wey geda to look make dem please no enta di area wey dem clea for emergency motr dem to pass," Carelse tok.