Oil spill: Court say Shell Nigeria dey responsible for oil spills for Niger Delta

Wia dis foto come from, Reuters
A Dutch appeals court don rule say di Nigerian branch of oil giant Shell na im dey responsible for leaks for di Niger Delta.
Di court order make Shell Nigeria pay compensation to Nigerian farmers, while im subsidiary and im Anglo-Dutch parent company go install equipment wey go prevent future damage.
Four Nigerian farmers who alleged widespread of pollution on dia land na dem launch di case in 2008.
Shell Nigeria fit appeal di ruling.
Di court say dem go determine di amount of compensation ''at a later stage''
Di farmers' case bin backed by environmental group Friends of di Earth.
End of Di one wey oda users dey read well well
''Tears of joy here. Afta 13 years, we don win,'' di Dutch branch of Friends of di Earth tweet.
Shell neva say anything about di ruling.













