You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
New Year: Dbanj welcome birth of daughter two years afta im first pikin die
Read am in 1 mins
Nigerian entertainer and businessman, Dapo Oyebanjo wey dey popularly known as D'banj don welcome di birth of e daughter - "babylet".
D'banj share di news for Instagram as im describe im "babylet" as "gift from di heavens".
D'banj call im wife for di post say she be strong woman, and e gbadun am as she take handle di pregnancy stage to born dia daughter.
Dis words from di Nigerian singer dey come two years afta dia first pikin bin die for inside swimming pool for June, 2018.
D'banj say dis na "one of di best gifts wey God don give me".
Since then, di couple don born anoda boy pikin wey dem call Zane.