Nigerian Police SWAT team: Nigeria police SARS to SWAT protest and five unique #EndSARS protesters

End SARS protests wey last for about eight straight days and still dey count across Nigeria, dey considered by many as di most organized.
Odas say na di first of a kind wey everibodi join hands to demand police reforms inside di west African kontri.
During protests and demonstrations like di #EndSARS, e dey normal to see pipo wey cari placard, sing come out, but some odas go one step further dis time.
#EndSARS get a very colourful look but dis I-no-go-gree waka no for dey successful without some pipo wey dey work to ensure say resources dey yanfuyanfu, pipo no dey taya and di environment no dirty.
BBC Pidgin look di mata, come find out say e get five types of 'pipo' wey make #EndSARS protests a shinning example of wetin successful protest suppose be.
1. Di entertainers
Dis bi di pipo wey come di protest ground to provide sometin for di pipo to watch and help make dem dey lively as dem dey match.
For Lekki, Lagos 9wia di protest tuff pass) some pipo dress like lawyer and doctors come di protest ground.

One come wit im power bike and begin dey do stnt to entaitain pipo.
End of Di one wey oda users dey read well well
For Alausa area, one group come out with dia bicycle and scatting shoes. One man dey even ride bicycle with im dog for di protest.
E even get pipo wey dress as clowns just to make pipo laugh during di protest.

Di chanters
Di na pipo wey continue to dey lead di songs and even dey create new songs wey go reflect wetin dem (di protesters) dey ask for.
Dis pipo be mostly men and some lady dem wey get stamina to shout for long time.

Wia dis foto come from, Davido/Fortune
Dem dey lead di "EndSARS" chorus wey protesters dey match to.
Without dis pipo, di protest go just be ordinary waka and pipo fit quickly dey bored.
Di flag bearers

Wia dis foto come from, Other
Anoda set of pipo wey dey close to di entertainers and chanters na di pipo wey dey pass dia own message with flags.
One man don dey popular sake of him pin flags and how im dey use am for di protest.
E don be subject of plenty fotos wey don go viral and wey also show di essence of di protest.
For Enugu, one girl fold her flag and sit ontop high statue dey cry sake of wetin she tok say SARs do her family.
Di cleaners

Dis pipo na di ones wey dey pick all di bottles and oda dirty wey di portesters dey put for ground.
Dem dey go about wit dia dustbin nylon dey pick all di tins so dat road no go dirty.
Di providers

Dis pipo dey very important to di success of di protest.
Dem be di ones wey dey provide food, water even transportation to pipo wey di ground.
For Ikeja, some pipo contribute money to buy bread, water and even rent DJ for di protest.
Di protesters wey dey Lekki provide plenty water and soft drink for pipo.
Di organisers

Dis na di pipo wey dey put money for ground for di protests.
Dem be di pipo wey dey offer dia services pro bono (free lawyer service), dem be pipo wey dey coordinate and do all di work wey be di engine ontop wia di protest stand.

Wia dis foto come from, Reuters
How dis particular #EndSARS protest start?
Young pipo for Nigeria begin dey protest late week afta video appear show say men of di Nigerian Police Force shoot one man and cari im car commot.
BBC Pidgin later find say di man no die but get injury and dey hospital.
But dat incident don led to protest wey don dey happun even afta di Inspector General of Police announce say dem don dissolve di Special Anti-Robbery Squad (SARS) wey cause di wahala.
For many days on, protesters still say dem no go gree and say dem want total and true reform for Nigeria.
BBC Pidgin don report on all di protests from across Nigeria and even di ones wey happun for outside Nigeria like UK and Ghana.













