You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Darasimi Mike-Bamiloye and Lawerence Oyor wedding fotos
Oga of Mount Zion production, Mike Bamiloye and Gloria Bamiloye last pikin Darasimi don marry her gospel artist bobo Lawerence Oyor.
Di marriage wey happun for Ibadan, Oyo state on Saturday 10th of October, 2020, bin dey two years in di making.
According to di couple, poet Darasimi Mike-Bamiloye bin take four months to respond to Lawrence proposal for 2018.
Tori be say na on April 2018, Lawrence bin propose to Darasimi but no be until di 25th of August, she gree for am.
Di traditional rights wey mix both Niger-Delta and Yoruba culture bin hold on Friday 9th of September.
BBC Pidgin don gather some of "Darasimi Mike Bamiloye and Lawerence Oyor wedding" fotos for you.
Check out Mike Bamiloye daughter wedding:
While dia white wedding hold for Saturday, di 10th of September, 2020.
Mike Bamiloye enta social media to wish im daughter well for her marriage.
End of Di one wey oda users dey read well well