You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kodak: President Trump say America go support di ogbonge camera company wey abandon foto and crypto currency, port go drug business
Eastman Kodak company dey port from producing photography film to production of medicine.
Di 131 years old company bin dey number one position for di manufacturing of film wey dem dey take snap photo for many many years.
Di camera company and photography giant fail to cross enta di 21st century era of digital cameras, even though na dem invent di first digital camera for 1975.
Later Kodak enta into cryptocurrency market but di cryptocurrency business no favour am.
Now, Kodak latest plan na to begin pharmaceutical business.
Dem plan to make ingredients for medicine afta United States goment give dem loan of $765 from di Trump Administration program wey dem create to helep America to fit make medicine for dis Covid-19 era.
Early dis week US presido Donald Trump do di announcement say federal goment go give Kodak di moni.
President Trump say, di company go eventually produce reach one quarter of all di active ingredients wey dem need to produce medicine for America pipo.
End of Di one wey oda users dey read well well
As of today, America dey import majority of di active ingredients from China and India.
Oga trump say, wit di new business wey Kodak wan enta now, America go fit compete "wit almost all kontris, and soon wit all kontris."
Di company stock rise reach 2,760% for stock market sake of di loan.
Bankruptcy
For 2011 di company cash drop to $957 million from di $1.6 billion wey dem bin get for 2001.
Di company declare bankruptcy for 2012 come collect credit from Citigroup to take reorganise im sef.
For 2013 Kodak announce say in don recover from bankruptcy.
Between 2014 reach 2018, di company don release manufacture different kain smartphones plus television but all na flop.