You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Coronavirus - Virus: Panic go cause more harm dan good - President Buhari
Nigeria presido Muhammadu Buhari, say make all Nigerians make sure say dem strictly follow all di advice from World Health Organisation, federal ministry of health and di National Centre for Disease Control on di coronavirus situation for di kontri.
Presido Buhari wey give Nigerians assurance on top social media, say make nobodi panic becos unnecessary alarm fit cause "more harm dan good."
E say di only informate wey pipo must send na di ones wey WHO, federal and state ministry of health and NCDC share.
Di Presido praise praise WHO, NCDC plus di goment of Lagos and Ogun state for dia correct response to do coronavirus situation for di kontri.