Afcon 2019: Black Stars fit win di cup for Egypt - Christian Atsu
Di Black Stars of Ghana don win di African Cup of Nations four times.
Di last time wey di team win am na for 1982 and most Ghanaians don dey hungry for anoda win for di tournament.
Dis year, dem dey Group F wit Benin, Cameroon and Guinea Bissau.


