Akpabio go dump PDP join us dis week - APC

Read am in 1 mins

Nigeria ruling APC party don announce say former Akwa Ibom state Govnor, senator Godswill Akpabio go dump PDP port enta dia party.

Senator Ita Enang announce dis one on top twitter. Im say APC go officially receive Akpabio on Wednesday 8 August.

Dis news na real U-turn from di tori wey don dey reign for two weeks now since APC senator, govnors and house of rep members port go PDP.

Akpabio na di current minority leader of di PDP for senate of Nigeria National Assembly.

APC United Kingdom do anoda tweet concerning di porting. Dem say acting President Yemi Osibanjo go follow oda APC parti members for Akwa Ibom state to formally receive Akpabio.

Akpabio neva tok anytin about dis mata. But as tins dey ground, e no go be news wen tori comot say im don join APC.