Stranded Nigerians: How Lagos govnor pay for 50 Nigeria fans wey hang for Russia 2018 World Cup to return home

Sammy Davis Nigeria ambassador to Russia dey tok to Nigerians wey dey stranded

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Sammy Davis Nigeria ambassador to Russia dey tok to Nigerians wey dey stranded
Read am in 1 mins

Nigeria embassy for Russia don put about two hundred Nigerians wey no fit come back home afta dem go watch FIFA 2018 World Cup for hostel.

Some of di stranded fans don go back dia kontri afta Lagos state govnor Ambode Akinwunmi buy ticket for 50 pipo.

Oluremi Banwo Kehinde wey dey run anti-trafficking NGO for Russia tell BBC say, some of di fans bin dey airport for eleven days before govnor Ambode land Russia to go watch World Cup final.

Kehinde say, afta di fans yan am di wahala wey dem dey inside, im use im own moni buy ticket for dem on Friday to return home.

Oluremi Kehinde

Wia dis foto come from, Oluremi Kehinde/Faccebook

Wetin we call dis foto, Oluremi Kehinde na anti-trafficking activist wey dey helep di stranded Nigerians

Yulia Siluyanova wey be head of Alternativa bin tell AFP say her NGO don also send 50 Nigerians go back dia kontri.

More dan 400 Nigerian fans bin dey stranded for Russia afta dem go watch Nigeria play.

Many of dem sleep for domot of Nigeria Embassy for Mamontovsky Lane, Moscow, as dem bin no get moni to come back home or pay for hotel.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

419 pipo for Nigeria bin convince dem say, if dem buy World Cup Fan ID for $300 plus return ticket, dem go get employment for Russia.

But wetin dem see for Russia na different tin. To make am worse, di scammers cancel dia return tickets.

So far, Nigeria goment neva give any moni to take bring im kontri pipo back.