Anambra State Govnor, Charles Soludo don tok say im dey certain say im party All Progressives Grand Alliance (APGA) go win di gubernatorial election.
Di flagbearer of di party, Soludo tell tori pipo afta im cast im vote for im polling unit say even if di opposition party dey share 100,000 naira to buy votes, im dey certain say if dem count di votes, im go win wit "landslide"
Soludo cast im vote afta im arrive for im polling unit for Ofiyi Square, Isuofia, Aguata LGA of di state.
Di incumbent govnor tok say di elections in di state dey peaceful, while im accuse opposition party of buying votes for 50,000 naira.
"E dey peaceful and e dey go peaceful. E get reports for some polling for Olumbanasa wia BVAS no dey work, but e dey go on smoothly," e tok.
"Concerns wey we dey receive na for Nnewi South LGA wia we understand say dem dey buy votes massively.
One of di candidates from dat local govment wey dey desperate to win di local govment dey share 50,000 naira to voters and I tok say even if dem share 100,000 naira, make di pipo just vote. Count di votes na wetin mata for us and we dey convince say on di basis of di vote we go win wit landslide." E tok.
"Now as for di process, e dey seamless and di crowd dey vote but in di next one hour voting go close. I expect say all dis pipo go vote."
Pipo bin hail am wen e show up to vote and security pipo also dey ground to guide di place.