Di former Nigerian president, na one of di kontri most
beloved figures, e die at di age of 82.
Na one politician wey im politics dey different from di
rest, e dey quiet and courageous.
Buhari dey among di few Nigerian leaders wey dey honest.
Di former president tok-tok pesin, Femi Adesina, tok say
"No way to link Buhari to corruption".
Most of di pipo love Buhari becos of im honest and
law-abiding nature.
- E no spend too much time wit im papa
Dem born Muhammadu Buhari in December 1942 for Daura,
Katsina State, 18 years bifor Nigeria gain independence.
Im Fulani papa die wen Buhari bin dey four years old, na
only im Kanuri mama raise am.
For one interview in 2012, Buhari tok say im be di 23rd
child of im papa side and di 13th for im mama side.
- Chadian military offensive in Nigeria dismantled
One of di tins wey make Buhari reputation spread for Nigeria
na im command of one Nigerian battalion for one fight between Nigeria and Chad.
E happun for 1983, when Chadian troops occupied some islands
in Lake Chad.
In the final months of 1983, di military hijack di goment of
former president Shehu Shagari.
Buhari, dat time hold di rank of major general, become di
military leader afta di coup.
Buhari tok say im no dey among di pipo wey start di coup,
dem just install am, and di same pipo later remove am.
E bin spend just 20 months for office.
- Fighting against corruption
During Buhari time for power in Nigeria, many tins change.
Wetin pipo go take remember about im first term for office
na im policy of fighting corruption.
Di goment arrest around 500 politicians on corruption
charges.
Some see dis policies by di Buhari administration as
tyranny, while oda see dem as commendable step in din fight against corruption,
wey fit destroy di kontri and prevent di kontri progress.
During dat time eem bin arrest famous musician Fela Kuti on
suspicion of money laundering.
- Imprisonment afta di coup
Afta 20 months in power, dem hijack Buhari goment, den
General Ibrahim Babangida take power.
Afta di coup, e catch am and throw am for prison for 40
months in Benin City.
Dem release Muhammadu Buhari for December 1988, afta im mama
die.
- Petroleum Transfer Fund (PTF)
Since im release, Muhammadu Buhari return to simple life den
di Nigerian military General Sani Abacha appoint am as di chairman of di
Petroleum Resources Fund (PTF).
Dem use di money wey dem generate from di fuel price
increase for development projects.
- E try three times bifor e succeed
Muhammadu Buhari enta politics in di early 2000s, to return
to di presidency.
In 2003, he run for president, but former president Olusegun
Obasanjo defeat am.
E run for president again in 2007, but former president
Umaru Musa Yar'adua win.
In 2011, afta e run for third term, Buhari announce say im
go retire from politics.
At di time, e tok say, "Dis na di third and final time
for me. I no go run for president again. I no need anything and I no get anytin
tok wey I neva tok bifor."
However, two events bring Buhari back into politics in 2015
elections. Security and economy.
As former president Goodluck Jonathan don almost finish im
tenure high living standard, allegations of corruption and security concerns
dey on di rise, particularly Boko Haram. Some politicians in di kontri seize
dis opportunity to bring Buhari to power.
Buhari become di elected president in 2015, na di first
opposition leader to defeat di incumbent president since di kontri return to
democracy in 1999.
Afta returning to power, one of di biggest challenges Buhari
face na sickness.
Buhari spend plenti time for sickbed during im
administration seeking medical treatment, especially during im first tenure.
E get one time wey e spend 50 days for London wia e dey
receive treatment.
Some believe say di late president health play big role in
im failure to fulfil some of im commitments.