You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Ondo Decides: Vote sorting and counting don begin as polls close

Dis na live coverage of di 2024 governorship election for Ondo state

Summary

Live Coverage

Victor Ezeama and Fiona Equere

  1. Na here we go match break for now for our coverage of di Ondo state govnorship election.

    In case you miss am, dis na some keypoints from di election so far.

    • Voting don end for Ondo state where residents bin come out to vote for dia next govnor
    • Di election bin dey characterised by a low turn-out
    • BBC record cases of vote buying and selling
    • Di election dey mostly peaceful except for some tori about ballot box snatching for Idanre.
    • Inec never tok wen collation and announcing of result go start

    You fit scroll down to see more tori on how di election day waka.

    We go come back wen I nec begin announce di result!

  2. Yiaga Africa say case of vote buying dey for Ondo govnorship election

    Yiaga Africa, one civil society organisation wey dey chook mouth into electoral matter tok say dem observe cases of vote buying for different polling units for di ongoing Ondo state govnorship election.

    Di group tok dis one wen dem dey give dia situation report about di election wia dem tok say dis issue of vote buying dey contribute to electoral corruption.

    Remember say BBC capture moments wey some voters begin collect money afta dem cast dia votes for di Ondo State govnorship election. Di open vote-buying occur for unit 016, Ahmadiyya Grammar School, Owo local goment area.

    But one oda incident wey Yiaga mention happun for St. Stephen Polling Unit in Ward 4, Akure and men of di DSS bin gbab di pesin wey dey involved for di mago-mago.

    Di group say election officials and materials bin arrive early for polling units wey dem observe.

  3. Ondo state governorship election result live updates

  4. EFCC say dem monitor Ondo state election to find vote buying and selling

    Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) say dia men dey ground for Ondo state to find pipo wey involve in vote buying and selling during di election.

    According to informate for dia X page, di commission say dem monitor di election to ensure say dem check everi form of electoral offences wey go happun.

    "Operatives dey all ova di state in line wit di mandate of di commission to prevent, investigate and prosecute all forms of economic and financial crimes," EFCC tok.Meanwhile, counting for di 2024 Ondo state election don begin.

  5. Low turnout characterise Ondo election for many polling units in Akure

    Voting don end for all di polling units for Akure South and Idanre LGA's for Akure, di capital city of Ondo State, wia BBC Pidgin tori pipo monitor.

    Di exercise bin go peacefully for majority of di polling units, even though e get some tori about ballot box snatching for Idanre.

    Security pipo do dia work, including army, police, civil defence, and road safety and many of dem still dey for road to enforce di movement restriction wey di police bin put in place.

    Our tori pipo no witness any form of violence for di polling units, except for one place for Idanre wia some boys come to say dem be polling unit agents, come wan disrupt di voting, but di voters no allow am to happen.

    Di one wey clear for dis governorship election na voter apathy.

    As at 12 noon, voting don stop for many polling units and di Inec staff pipo just sidon dia dey wait make 2.30pm reach bicos dat na di time wey Inec tok say voting suppose stop.

    Immediately 2.30pm nack, di Inec pipo begin sorting and counting of votes and e no take more dan 15 to 20 minutes for dem to finish and pack dia equipment comot.

  6. Police cut warning give pipo of Ondo state to observe movement restriction

    Di Nigeria police for Ondo state don cut warning give pipo for di state say di vehicle restriction na from 6:00am to 6:00pm.

    E mean say voters no suppose waka during election period but make dem cast dia vote for di polling units and dey safe.

    Also, police say dem don deploy drones wey go monitor di election.

    "If you see drone wey dey fly around INEC office and some of di polling units, no fear, di drones na for police for election monitoring," Ondo state police tok.

  7. Inec officials don dey pack comot from polling units

    As voting don end for many polling units especially for Akure, di Ondo State capital, Inec adhoc staff don dey pack dia equipment dey comot.

    Many of dem dey head to dia RACs (Registration Area Centres) wia di ward collation go take place bifor di local goment collation, and den di general collation.

  8. PDP win polling unit 17, ward 06, Akure South LGA

    Result from polling unit 17, ward 06, Akure south LGA show say PDP win dat side.

    ADC - 2

    APC -50

    PDP - 67

    NNPP - 3

  9. Result from Akure South LGA

    According to report wey we don see from dis polling unit for Akure South LGA, APC take di lead.

    Result for polling unit 07 ward 04 Ijomu/ Obanla Registration, Akure South LGA.

    ADC - 4

    APC - 102

    LP - 01

    PDP - 66

  10. Result from one polling unit for Akure south Local government Area

    APC win for Ijomu Obanla Polling unit 027, Akure south Local government Area.Wit 77 votes for APC,

    46 votes for PDP,

    Two votes for ADC

    One vote for LP.

  11. Fotos show how vote counting dey go on for Akure

    For some areas for Akure, vote counting don start.

    For polling unit 17 ward 4 Akure, di adhoc staff show di voters and party agents di ballot box and di paper bifor dem begin count.

  12. Nigeria Minister for Youth development vote for Ondo election

    Di minister fro youth development, Ayodele Olawande don vote for di on going Ondo state election.

    Olawande bin vote for polling unit; Ward 9, Unit 20, Akure South local govment.

    "To see di excitement for di faces of voters show my belief for democracy as system of govment wey offer citizens di chance to make dia own choice," di minister tok afta e cast im vote.

    Di minister praise security agencies, observers, INEC officials, corps members wey serve as adhoc staff for di election.

  13. Vote counting don start for Ondo state governorship election

    Counting of ballots don begin for di Ondo state govnorship election afta voters wey dey queue cast dia ballot.

    For polling unit 17 ward 4 Akure, di little voters wey wait for di area don ready to count di ballot.

  14. Inec give update on Ondo govnorship election

    Inec don give update on di Ondo state govnorship election so far and how voters turn out.

    Dem say of di 3,933 Polling Units (PUs) across di 203 Wards for di 18 Local Government Areas (LGAs) of Ondo State, 3,823 (97 percent) open by 8.30am.

    While di remaining 110 PUs open between 8.31am and 10am.

  15. Camera catch political party officials dey buy votes

    Case of vote buying happun for unit 016, Ahmadiyya Grammar School, Owo.

    Camera catch party officials wia dem dey share money give voters for Owo local govment area.

    For di video, some men gada togeda to share di money as voters surround dem dey collect money.

    One old mama wey show for di video count her money well well.

    Meanwhile, vote buying and selling na offence for election, according to Inec.

  16. Voting don stop for plenti polling units for Ondo

    For most polling units for di Ondo state, voting don stop sake of low turn out of voters.

    BBC Pidgin reporter Andrew Gift say ova 50 percent of Akure south LGA wey im visit and some parts of Idanre LGA turnout of voters dey very low.

    But di Independent national electoral commission adhoc staff tell BBC Pidgin say dem go wait until 2:30 pm bifor dem go start to count di votes.

  17. Nigeria Minister for Interior cast im vote for ongoin Ondo election

    Di minister of interior Olubunmi Tunji-Ojo don cast im vote for di ongoing Ondo state govnorship election.

    Tunji-Ojo wey vote at around 11:34am for im area for polling unit 17, Ward 3, Akoko North-West local govment area of di state.

    Di minister say di election dey go peaceful.

    "Na peaceful election wit officials wey dey display high level professionalism wit encouraging turn out of voters," di minister tok.

  18. Wetin Nigerians dey tok for social media about Ondo Election?

    Some Nigerians dey react for X, about di Ondo govnorship election wey dey take place Saturday November 14.

    Dem dey use di #ONDODECIDES to tok why many pipo no really dey ginger about dis election.

    @ayemojubar say ‘’E dey hard to believe say election dey happun for Nigeria today, see as everywhere dry, even though one state dey choose dia next govnor. Dis show how deep pipo don lose faith for our electoral process and Inec’’.

    @henry35120601 say ‘’Pipo no really turn up for dis election sha, Inec don too disappoint Nigerians’’.

    @tosinadex say ‘’So far, #ONDODECIDES #Ondo2024 looks like an improvement on Edo elections, we dey hope and pray say di collation process go well too... dat na di devil of di process’’.

    @klisco1 say I cast my vote. ‘’You no go believe how dem dey give money for my polling unit. Nigeria still get a long way to go’’.

    @hasolity say ‘’Make una vote wit una sense no vote wit your pocket’’.

    @abbanuso say ''congratulations in advance to APC.''

  19. EU Delegation dey observe di Ondo govnorship election

    Di European Union delegation dey observe di govnorship election for Ondo state.

    For inside X, EU say dia observers don visit key locations for di south west state.

    So far, dem don visit polling units for Oba-Ile Second Gate, Oloba Junction, and OSRC Post Office, Akure North.

    18 candidates dey contest for highest office of di land including di Govnor Lucky Aiyedatiwa from di ruling All Progressive congress party.

  20. PDP govnorship candidate Agboola Ajayi cast im vote

    Di candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), Agboola Ajayi don cast im vote for Polling unit 4, Ward 2, Kiribo Apoi, Ede-Odo LGA.

    Ajayi wey be 54-year-old na di flag bearer of PDP for dis 2024 Ondo state governorship election.

    E appear for im polling unit wia e join di queue for accreditation bifor e move forward to cast im vote.