'I tell my boy to come down say I go face dis alone' - Ejiro Otarigho narrate how e drive burning tanker to save lives

Wia dis foto come from, Others
''I just do one massive testimony for my church now wit members of my community," na so man wey drive burning tanker tok days afta e save residents from wetin for cause major disaster.
For one video wey don circulate online, Ejiro Otarigho drive di burning vehicle comot from one densely populated area for Agbarho Town, Ughelli North, Delta State, to reduce damage in case of explosion.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Im drive di truck wey bin dey engulfed in flames go one area wit no houses or stores, im also escape di burning truck alive, as nobody injure.
Oga Ejiro wey newly do im traditional wedding tell BBC say na di community im dey stay na dia di tin happun.
"Na dia I dey live, and we thank God for di problem wey im remove from our lives", im tok.
Ejiro narrate how e happun

Wia dis foto come from, Ejiro Otarigho
"Di incident happun on di 10th of June at about 7pm for evening.
I bin dey drive di tanker wey dey loaded wit fuel.
I bin don discharge some of di product and I just dey comot one of di places wia I go deliver some of di product, all of a sudden my boy just shout out say ‘oga see fire’.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di area dey populated. Wen I see say di fire na massive one and e don begin bring out flame. I tell my boy make im come down so dat I go face di game all by myself.
My boy jump down and I begin drive di truck for about 15 mins from wia e begin catch fire.
I drive go one open place wey dey close to di river.
My intention na to drive di truck directly to di river but wen I reach dia I see dem pack plenty cars for there.
I tell myself if I drive straight, di truck fit fall and explode and e go cause anoda gbege. So I drive di car to pack for di open space." Dat na how Ejiro take save di day.
Oga Ejiro for im interview wit BBC add say im wife dey nine months pregnant and about to deliver and dis dey come four months afta dem do dia traditional wedding.
E tok say im follow wit community members go thank God for church concerning di incident.
Many Nigerians don praise di tanker driver for im courageous effort as dem commend am for di act of bravery.
Nigerians hail Ejiro as 'hero'
Plenti Nigerians enta social media to celebrate Ejiro and call am ''hero''.
Dem believe say wetin im do dey risky and only hero fit do am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Governor Okowa tuale Ejiro heroic act
Govnor Ifeanyi Okowa of Delta state, south-south Nigeria don tuale Oga Ejiro Otarigho, for im bravery.
Di govnor say Oga Otarigho uncommon heroism prevent major disaster.
For statement wey di Chief Press Secretary, Olisa Ifeajika give, Okowa say: "We dey proud of you and we wan oda Delta pipo and Nigerians to do pass your heroics acts for all dia activities," Okowa tok.













