I go treat all Kano people equally and justly - Gawuna

Di All Progressives Congress candidate Nasiru Gawuna wey elections tribunal declare as di winner of Kano state govnorship elections tok say e dey happy and go treat all residents of di state justly.

For interview with BBC Hausa, di former deputy govnor also tok say all Kano pipo irrespective of di side wey dem dey support suppose come togeda to make di state great.

“All dis tin, we dey do am because of our Kano wey we all love, all of us suppose come togeda to move di state forward.”

Gawuna also tok say New Nigeria Peoples Party, (NNPP) dey within dia rights to appeal.

“Before, na NNPP dem declare as di winner and at di time na God we ask for guidance so we still dey on di same path.”

Di former commissioner of Agriculture also thank Kano pipo for dia support.

“Dis victory na from God and we dey also thank Kano pipo for all dia support and prayers.”

Di Kano state governorship election petition tribunal remove Abba Kabir Yusuf as govnor of Kano state, Northwest Nigeria.

Elections Tribunal for Kano state on Wednesday for judgement tok say make di Independent National electoral commission (Inec) withdraw di certificate of return dem issue govnor Abba Kabir Yusuf of Kano state and to give same to Nasiru Gawuna of All Progressives Congress (APC).

APC and dia govnorship candidate Nasiru Gawuna bin challenge di victory of govnor Abba Kabir Yusuf of di New Nigeria Peoples Party (NNPP) for di 18 March 2023 elections.

Di three-man panel presided over by Justice Oluyemi Akintan-Osadebay tok say 165,663 votes from oga Yusuf total votes dey invalid.

Dem also say di ballot papers no dey stamped or signed diafore dey invalid - so dem reduce di number of votes of di NNPP candidate by 165,663.

For March, Inec declare Yusuf, candidate of NNPP winner and return am elected, afta dem say e poll 1,019,602 votes to defeat Gawuna of di APC wey score 890,705 votes.

Ahead of di judgement day, di ruling party for Kano and di Kwankwasiyya movement, as well as di opposition All Progressives Congress (APC), bin embark on separate series of prayers seeking divine intervention for dia favor.

Di prayer sessions come afta both parties bin table accusation and counter-allegation of some attempts by some pipo to interfere with di judgement.

Justice Flora Azinge, one of di justices of di tribunal bin also raise alarm over attempt by somebody to offer N10 million to one of im staff with di intension to bribe.

Justice Osadebay bin don already pledge to do justice and be fair to all parties in line with di provisions of di law within di 180 days wey dem set for di judgement to happun.

Di ruling of di tribunal dey happun six months afta di APC candidate bin concede defeat to Yusuf afta di election.

For one audio wey e release for March Gawuna bin say “as a good Muslim”, im no get choice dan to accept di outcome of di election, weda e dey in im favour or not.

Di APC governorship candidate suggest say im no go challenge di outcome of di election even though im supporters tell am to go court.

E go interest you to sabi say di Kano state governorship election petitions tribunal deliver dia judgement via zoom for Miller Road Kano State High Court complex.

‘We go appeal di tribunal judgement’

New Nigeria Peoples Party (NNPP) say dem no dey in agreement wit di judgement for Kano state wey sack govnor Abba Kabir Yusuf and ask INEC to declare APC candidate Nasiru Gawuna as winner.

Ladipo Johnson wey be tok tok pesin for di party at di national level tell BBC News Pidgin say di judgement by di elections tribunal no dey in line wit di facts of di case.

“So one tin dey sure we go appeal dis judgement becos di ruling no dey in line wit di facts of di case.

“We no go gree at all and we go take di mata to appeal court,” oga Johnson tok.

Kano police command sama 24-hour curfew afta tribunal judgement

Mohammed Usaini Gumel, di state commissioner of police command on Wednesday tok say make residents comply wit di directives as dem don dispatch security operatives for evri corner of di state for di next 24-hours.

Di command tok say dis na based on di Kano state goment order.

Di curfew go take effect from 6 pm on Wednesday, 20 September to 6pm on Thursday, 21 September and violators of di curfew go face di wrath of di law.

“In view of di Constitutional mandate of di Nigeria Police Force alongside di relevant Internal Security and Law Enforcement Agencies to preserve law and order in di state,” di police commissioner tok.