'Nigeria 2023 presidential election no be di legacy wey Buhari promise'

Wia dis foto come from, Atiku Abubakar
Candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) for di just concluded 2023 presidential election, Atiku Abubakar don tok say im go challenge di outcome of di election.
Former Vice President Atiku make di declaration during press briefing wey im do for Abuja.
E say di presidential election wey hold on Saturday fall short of wetin election suppose be.
Di PDP candidate blame di Independent National Electoral Commission (Inec) for failing to follow dia own guideline for di election.
E call di 2023 presidential election, "Di worst election since di return to democracy from military rule".
Dis dey come afta Labour Party, hold dia press conference wia e say e go seek legal redress ova di election.
Atiku na di first runner up for di election and revel say im dey chill for im lawyers advice afta dem go through di results of di election.
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post
E say, "di 2023 election present our pipo a chance for a political reset. Inec fail woefully to live up to expectation."
End of Di one wey oda users dey read well well
E reveal say e bin no understand di haste by which Inec rush di announcing of results despite reports of kurukere waka.
Dis na even afta e tok say: "Afta consultation, I don come to di conclusion say di process and result was flawed and must to dey challenged by all of us."
While im neva tok if e go court, Atiku make am known say, "make di judiciary redeem dem sefs as di last hope".
E also call out President Muhammadu Buhari say time no dey late to redeem imself.
"Di battle no be about me, na about you and di future of you pipo wey dey listen to me.
"Na also in di interest of our democracy and ensure betta life.
"I know say Nigerians dey traumatized by di experience."
'Peter Obi chop some of my votes'
Atiku reveal say Peter Obi bin fear di wrath of govnors for di PDP na why e comot bifor di process bin start.
Dis na as im admit say Peter Obi bin take most of di PDP votes wen e go LP saying, "I go admit say im collect votes comot from our hand for South East and South South, howeva no be one particular region dey create president, you gatz win everwia".
Peter Obi bin run under di PDP for di vice presidency position for di 2019 presidential election wit Atiku Abubakar. Ahead of di 2023 election im bim first wan contest under di PDP - e later comot to contest under Labour Party.
For dis press conference oga Atiku say e for be di "stepping stone" of an Igbo presidency but Peter Obi bin too rush and bin dey fear di PDP govnor collabo wey bin wan make demselves president.
Nigeria election bodi di Independent National Electoral Commission on Wednesday declare di Presidential Candidate of di All Progressives Congress, APC, Bola Tinubu di winner of di 2023 election.
Di candidates of di APC, PDP and Labour Party bin dey neck and neck. Bola Tinubu win 12 states, Atiku Abubakar also win 12 states. Peter Obi too win 12 states including di FCT.
To win di presidential election for Nigeria, a candidate go need to get di most votes and 25% of ballots cast for two-thirds of Nigeria 36 states to be declared as di winner.
Prof Mahmood Yakubu, di chairman of di Independent National Electoral Commission (Inec) and di National Collation officer for di Presidential election announce for early morning of Wednesday say Tinubu meet dat criteria and dey returned elected.











