'I go be una chief-servant' - Tinubu tok for acceptance speech

President-elect Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Facebook/Bola Ahmed Tinubu

Wetin we call dis foto, Bola Tinubu give acceptance speech afta INEC declare am as President-elect

Di President-Elect Bola Ahmed Tinubu don assure Nigerians say im go be chief servant and go serve Nigerians wit everytin wey im get.

E tok dis one for im acceptance speech afta di Nigeria election joinbodi Inec announce am as di winner of di 2023 presidential elections.

Di 70-year-old veteran politician get about 36% of di vote, official results show.

For im acceptance speech, di president-elect promise Nigerians say im administration go bring peace, unity and prosperity and wen pipo see wetin dem accomplish in di coming years, dem go speak wit pride say dem be true Nigerians.

E promise to be a fair leader wey go dey in tune wit pipo aspiration and go harness dia talents to deliver a kontri wey everybody go dey proud of.

To candidates wey dem gada contest for di position of presidency, e extend hand of friendship, say now na time for dem to build di kontri togeda.

“To my fellow candidates, former VP Atiku, former Govnor Kwankwaso, former Govnor Obi and all odas, I extend di hand of friendship. Dis na competitive, high-spirited campaign.

“You get my utmost respect.”

“Political competition must now give way to political conciliation and inclusive governance.

“During di election, you fit don be my opponent but you no ever be my enemy. For my heart, we be brothers.

“Whether you be Batified, Atikulated, Obidient, Kwankwasiyya, or you get any oda political affiliation, you vote for better, more hopeful nation and I thank you for your participation and dedication to our democracy.” Tinubu tell everybody wey embrace di electoral process.

'For pipo wey dey vex for di result'

Di President-elect say make pipo wey no fit accept di result go court.

“I know some say e go hard for some candidates to accept di election results. Na your right to seek legal recourse. Wetin no dey right nor defensible na for anybody to resort to violence. Any challenge to di electoral outcome suppose happun for court of law, and no be for streets.

Yes, division dey among us wey no suppose exist. Many pipo dey uncertain, angry and hurt; I reach out to every one of you. Let di better aspects of our humanity step forward for dis fateful moment. Let us begin to heal and bring calm to our nation.” Tinubu tok.

For di youth

Di president-elect assure di youth say e hear dem loud and clear and e understand dia pains.

"To di youths, I hear you loud and clear. We go embark on dis journey togeda, united. In Sha Allah, we go work togeda, I go pay undivided attention to your education, credit go dey available, education loan. 4-year course go be 4-year course, no more strike.

"Your universities go get dia autonomy. No more selling of handouts, dem must write. I know wia e dey pain and believe me, you go see di reward of your election." Tinubu promise.

President Muhammadu Buhari, governors, politicians congratulate di President-elect

Bola Tinubu and President Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, Femi Adeshina/Facebook

Wetin we call dis foto, President Muhammadu Buhari say Bola Tinubu na di best man for di job

Nigeria President Muhammadu Buhari don congratulate di winner of di just concluded presidential election, Bola Tinubu, e say e bi di best man for di job.

Di presido say im go work wit Tinubu and im team to ensure orderly handover of power.

Buhari for im congratulatory message say, although di exercise get small faults like technical problem wit di electronic transmission of results, however, none of di issues wey dem get represent challenge to di freeness and di fairness of di elections.

To pipo wey no agree wit di outcome of di election, di Nigerian leader say make dem go court.

Lagos state govnor Babajide Sanwo-Olu, former Ekiti state govnor, Ayodele Fayose don tweet dia congratulatory message give Tinubu afta INEC announcement wey declare am as winner of di 2023 presidential elections.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

How some Nigerians dey react to Bola Tinubu win

Supporters of Nigeria ruling APC party don begin enta street for di commercial hub of Lagos to celebrate afta dem wake up to di news say Bola Tinubu win for di presidential elections.

Celebrations also dey go on for di kontri capital, Abuja, following di announcement of di chairman of di election joinbodi.

However, di Presidential candidate of di African Action Congress Party, Omoyele Sowore for im reaction tweet say "At di end, shift in consciousness dey."

APC supporters dey celebrate

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, APC supporters dey celebrate
Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 4