Miss Japan give up her crown afta reports say she date married man

Di winner of Miss Japan pageant wey dem born for Ukraine don give up her crown afta tori comot say she bin get affair with married man.

Dis gbege comot two weeks afta 26 year old Karoline Shiino collect her crown, even afta her win vex pipo sake of say dem no born am for di kontri.

Na in di middle of dat gbas-gbos one local magazine comot with di tori of di affair.

Tori from di Shukan Bunshun tok say Ms Shiino bin dey date one married influencer and doctor but di man neva comot to tok anytin.

At first di organizers bin defend Ms Shiino say she no know say di man get wife.

But on Monday, organisers say she confess say she bin know say di man bin dey married and she bin sabi im family.

Di Miss Japan Association say she tok sorry for misleading dem and organisers don accept her title resignation.

Ms Shiino also tok sorry to her fans and di general public for statement on Monday. She say she bin act out of fear and panic to ansa di tori.

She say, "I dey very sorry for di big trouble I don cause and say I betray di pipo wey support me."

Di Miss Japan title go now dey empty for di rest of di year even though plenti runner ups dey ground.

Di competition bin crown Ms Shiino for 22 January, wey make am di first pesin wey get European descent wey dem don crown.

Dem born her for Ukraine before she follow her mama go back Japan wen she be five years old and come take her step papa surname.

Wen she bin get di title, her speech tok say, "I bin no dey accepted as Japanese plenti times but I dey grateful to dey recognised by Japanese today."