Sanwo-Olu cancel govnorship debate afta violent clash by thugs for Lagos

Wia dis foto come from, BABAJIDE SANWO-OLU
Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu don tok say im no go participate for any public function, especially govnorship debate wey go involve di Peoples Democratic Party (PDP).
Di govnor tok say im reason na sake of di recent attack wey happun for Surulere area of di state wey lead to destruction of property.
Lagos na Nigeria commercial capital for Southwest of di kontri - na one place wey many pipo dey monitor ahead of di general elections next mont.
Gbenga Omotosho, commissioner for information and strategy for statement say di govnor accuse di PDP govnorship candidate for di state Abdul-Azeez Adediran, alias Jandor of using thugs to unleash violence on residents of di area.
Wetin happun
Na plenty pipo wunjure on Friday for Aiyetoro, Surulere area of Lagos wen suspected thugs of di All Progressive Party and di Peoples Democratic Party clash.
One video wey go viral on top social media show as thugs unleash violence on dem sefs – pesin fit hear sound of gunshots for di video.
Di video also show how pipo dey run run and cars dey make u-turns to try avoid di violence.
Shop owners within di area also quickly lock di shops while roadside traders also find how to hide for safety.
Di thugs destroy cars and campaign vehicle of one of di parties wey dey try escape di scene.
Police later enforce into di area – by den di armed thugs don discharge.
SP Benjamin Hudenyin, confam di clash but say na three pipo wunjure. “Nobody die,” e add
APC, PDP trade blames
But di PDP don deny am and accuse di ruling party say na dem use thugs to attack supporters of dia candidate.
Govnor Sanwo-Olu say security agencies dey investigate one viral video where thugs dey shoot in broad daylight for Surulere.
“Security agencies dey investigate di video, wey don go viral for social media.
"We believe say dem go fish out and prosecute di evil actors, wey be henchmen of di opposition Peoples Democratic Party (PDP).
“We condemn dis savagery wey don portray our state, di safest for Nigeria, in a bad light. No be who we be; we dey civilised and cultured,” di govnor tok.
Di govnor say sake of advice from competent sources, including elders and respectable Lagosians, im go shun any forum wey go involve di PDP.
'We no go attend The Platform'
Sake of di violence, Govnor Sanwo-Olu say im no go attend The Platform Governorship Debate wey Pastor Poju Oyemade of di Covenant Christian Church dey host today.
For di statement, di govnor tok say im regret say im no go participate for di debate.
“The govnor hold Pastor Poju Oyemade and The Covenant Nation Church family in high esteem and cherish future opportunities to engage di congregation and render accounts of im stewardship to dem as integral parts of di Lagos electorate.
“We no go dey in di company of pipo wey lives of innocent Lagosians no mean anytin to. Oga Sanwo-Olu no go share podium wit dem,” di statement tok.
For one statement by Govnor Sanwo-Olu tok-tok pesin, di incident wey happun for Surulere claim di lives of three pipo and injure many odas.
Oda attacks for Nigeria sake of elections
Several attacks don happun across di kontri ahead of di general election.
Na thugs and hoodlums dey carry out most of di attacks wey don lead to destruction of property.
For October 2022, thugs attack di Lagos State govnorship candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), Abdul-Azeez Adediran, for Ikoga Junction area of Badagry as e dey return from visiting members of im party.
Di PDP candidate blame di All Progressives Congress (APC) for di attack and claim say di thugs bin dey shout APC as dem dey shoot guns and use dangerous weapons.
APC deny dis claim wey di PDP candidate make.
Also for Lagos, hoodlums bin attack di convoy of di presidential candidate of di APC, Bola Ahmed Tinubu for Lagos Island.
Di incident happun for Ebute-Ero-Adeniji-Iga-Iduganran axis for Lagos Island afta Tinubu meet wit di Oba of Lagos and dey on im way back to Bourdillon, Ikoyi where im dey live.
For Osun State, hoodlum attack one Labour Party (LP) chieftain Rabiu Ismaila and odas sake of say dem paste posters of House of Representatives candidate for Atakumosa East Local Governmen Area, Kunle Gideon.
Ismaila say di incident happun on 30 November 2022, and add say na six thugs attack am.
Hoodlums set di office of di Independent National Electoral Commission for di Igboeze North Local Government Area of Enugu State on fire for 3 July 2022.
Reports of attacks don also come from Zamfara, Rivers, Kaduna, Ebonyi, Kastina and oda parts di kontri.
According to one statement by INEC National Commissioner, Information and Voter Education Committee, Festus Okoye, di hoodlums overpower security guards of di commission office and force dia way into di premises to burn di building down.
INEC, FG and police tok on 2023 elections

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Independent National Electoral Commission (Inec) bin raise di alarm ova di rising security situation across di kontri and how e fit impact di 2023 general elections.
For January, chairman of di electoral body Professor Mahmood Yakubu represented by di chairman of Board of Electoral Institute, Abdullahi Zuru, at di validation of election security training resources for Abuja, say di elections face serious threat of cancellation if di insecurity across di kontri get worse.
Inec don come out to assure Nigerians say notin go make dem cancel di election.
Nigeria goment on 10 January assure dia kontri pipo say di 2023 general elections go happun as dem plan am.
Di kontri Minister of Information and Culture, Lai Mohammed, na im give dis assurance for di kontri caital Abuja during di 17th edition of President Muhammadu Buhari Administration Scorecard Series from 2015 to 2023.
Oga Lai tok dis one as im respond to news from Inec say di general elections dey face serious threat of cancellation due to insecurity.
But di minister say di position of goment be say di election go happun.

Wia dis foto come from, Getty Images
For October last year, di Nigeria Police Force say di 2023 general elections go hold under peaceful atmosphere for all di geo-political zones of di kontri.
Di police tok-tok pesin CSP Olumuyiwa Adejobi say di threat analysis wey dem carri out neva reveal say di elections no go dey peaceful.
“Di North East and the North West wia diz fears dey come from don dey stable as security agencies don flush out di criminal elements. We dey in di process of building peace for di area now,” CSP Adejobi tok.










