Emeka Ihedioha resign from 'weak' opposition PDP

Wia dis foto come from, Emeka Ihedioha
Former Govnor of Imo State Emeka Ihedioha don comot from di Peoples Democratic Party (PDP).
Di former deputy speaker of di House of Representatives say im no dey do again as im drop in resignation letter on Tuedsay wey im address to di party chairman for Mbutu Ward of Aboh Mbaise Local Goment Area of Imo State.
For inside di resignation letter wey dey trend for social media titled, 'Resignation from di Peoples Democratic Party,' Emeka Ihedioha wey be member of PDP since 1998, tok say im dey comot from di party sake of say dem no fit be 'strong opposition party' for Nigeria.
"Since 1998 I don contribute my quota to di development and transformation of di Peoples Democratic Party as one of di founding members.
All dis years, I dey take pride say PDP na party wey go always look inward for internal reforms and provide credible internal leadership for di pipo, weda dem dey for power or out of power.
I don serve and benefit from di party for different levels." Ihedioha tok inside di letter.
Di former House of Representatives member wey don dey for di party for 26 years add say im regret di road wey di party dey follow in recent times and dat road no dey in line wit wetin im believe.
“Regrettably, in recent times, di party don dey waka for road wey no agree wit my personal beliefs. Despite my attempt to offer counsel, di party sadly no fit carry out internal reforms, enforce dia own rules, or offer credible opposition to di ruling All Progressives Congress.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na sake of dis, I dey compelled to offer my resignation from di People’s Democratic Party wit immediate effect.”
Emeka Ihedioha say even though di decision dey "difficult," im go work to make sure say democracy for di kontri continue to dey strong.
“Even though dis decision dey difficult for me to take, I however believe say na di right one.
Even though I don resign, I go always dey available to offer my services towards di deepening of democracy and good governance for Nigeria.”

Wia dis foto come from, Emeka Ihedioha X
Nigerians don begin react to di resignation of Emeka Ihedioha from PDP.
Since di letter come out, Emeka Iheadioha begin trend as Nigerians chook mouth for di resignation mata.
While some dey support di resignation, odas allege say di leadership of di party no do well.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis dey come as di PDP dey get some internal issues. Di party bin don set up committee to reconcile members.
Di Party dey show face for different tori since di build-up to di 2023 Presidential election.
One of di katakata for di party na di G5 govnors group wey former River State govnor and now FCT Minister Nyesom Wike bin form during im campaign for Presidency.
Emeka Ihedioha Profile
Emeka Ihedioha na former govnor of Imo state from 2019-2020.
Dem born oga Ihedioha for 24 March 1965 for Mbutu Aboh Mbaise Local Goment Area for Imo State, South-East of Nigeria.
E bin represent Aboh Mbaise/Ngor Okpala Federal Constituency of Imo State from 2003 to 2015 for di House of Representatives.
Im serve as deputy speaker for di House of Representatives from 2011 t0 2015.
Im dey married to Ebere Ihedioha and dem get four children Emeka, Ezinwa, Nkem and Kamsi.
Oga Ihedioha graduate from University of Lagos, Akoka-Yaba, where im obtain im Bachelor of Science (B.SC) degree for Food Science and Technology, for 1988.
On 9 March 2019, Ihedioha contest for di govnorship seat for Imo State under di PDP.
11 March 2019, Independent Electoral Commission declare Ihedioha as Governor-elect.
On Tuesday 14 January 2020, Supreme Court for Nigeria sack Emeka Ihedioha as di govnor of Imo state.
Dem declare Hope Uzodima as di winner of di 2019 govnorship election.
Di highest court for di Nigeria remove Emeka Ihedioha as govnor of Imo state sake of say im no score majority of di lawful vote for di March 9 2019 govnorship election.
For di election, oga Ihedioha of di People Democratic party score 273,404 votes while Hope Uzodinma of di All Progressive Congress party score 96,458 votes.
Senator Hope carry fourth according to di result wey election office Inec bin release.














