Air Canada flights go resume afta govment tell union to end strike

Read am in 4 mins

Air Canada flights go resume on Sunday afta di govment order cabin crew to end strike wey bin lead to hundreds of cancellations, di airline tok.

Di Canadian Industrial Relations Board (CIRB) tell staff to return to work by 14:00 EDT (18:00 GMT) and say one agreement wey dem bin joinbody do expire on 31 March and dem go extend am until dem agree on new one, Air Canada add.

Jobs Minister Patty Hajdu order binding arbitration to end di dispute, afta more dan 10,000 Air Canada flight attendants waka comot on Saturday wey cause 700 cancellations.

Di union bin accuse di govment of "caving to corporate pressure", afta dem resist a forced agreement.

Hundreds of flights suffer cancellation

Air Canada bin suspend all dia flights becos of strike by dia cabin staff and di move bin disturb travel plans for lots of passengers.

Di union wey dey represent more dan 10,000 Air Canada flight attendants bin confam di 72-hour industrial action early Saturday morning.

Di airline bin tok say dem don suspend all flights, wey include di ones wey dey under dia budget arm Air Canada Rouge, and advise customers wey dey affected make dem no travel to di airport unless dem dey fly wit different airline.

Canada largest airline bin start to suspend dia flights on Thursday afta di union of flight attendants bin give 72-hour strike notice.

Air Canada bin say dem dey disappointed well-well by di decision to strike.

During one press conference on Thursday, di union bin force dia way into di centre and stop wetin di Air Canada executive vice president dey tok.

"Dis na situation wey dey avoidable," Air Canada executive vice president Arielle Meloul tok during di press conference.

Although, Canadian jobs minister Patty Hajdu bin say make Air Canada and di union return to negotiation to avoid di strike, but e no work.

Why Air Canada flight attendants go on strike

Di Canadian Union of Public Employees (Cupe) wey get 10,000 Air Canada attendants bin provide strike notice on Wednesday afternoon.

Di union say dem bargain in good faith but Air Canada no address issues wey surround wages and unpaid work.

Why Air Canada flight attendants dey strike be say dem dey call for higher salaries. Dem also want di airline to pay for work even wen di aircraft dey for ground.

Early dis month, 99.7% of employees by di union bin vote for strike. Sake of dis strike, di airline say around 500 flights go dey affected per day.

Flight attendants bin show for major Canadian airports, wia passengers dey try find new bookings early dis week.

Air Canada wey dey fly directly to 180 cities worldwide, say dem "suspend all operations".

By Friday night, di airline bin say e don cancel 623 flights wey affect more dan 100,000 passengers.

Di airline say e offer flight attendants 38% increase in total compensation ova four years, wit 25% raise for di first year.

But di union say di offer dey "below inflation, below market value, below minimum wage" and go still leave flight attendants unpaid for some hours of work wey include boarding and waiting for airports ahead of flights.

Wetin go happun to passengers of Air Canada

Customers wey dia flights dey cancelled go get notification and dem go receive full refund, according to di airline.

Di company say dem don also make arrangements wit oda Canadian and foreign carriers to provide customers wit alternative travel options.

Customers go dey notified of di alternative options, but e fit take time or fit no dey immediately possible.

Who go dey affected by di Air Canada strike

Air Canada dey operate for 64 kontris wit fleet of 259 aircrafts. And dem say di unplanned shutdown na "major risk" to di company and dia employees.

Di flight cancellation dey expected to affect 130,000 daily customers, wey include 25,000 Canadians, wey dey travel during di summer period.

According to di airline, dem say about 623 flights bin dey cancelled and e go affect more dan 100,000 passengers.

Reporting by George Wright