Nigeria goment dey try break ASUU rank by approving breakaway factions - Labour leader

Wia dis foto come from, Federal Ministry of Labour
Di news wey comot on Tuesday say di Nigeria goment Nigeria goment don present certificates of registration to two new unions for di academic sector don begin generate plenti reactions.
On 4 October, di Ministry of Labour thru im minster, Chris Ngige bin present certificate of registration to two academic sub-unions wey be di Congress of Nigerian University Academics (CONUA) and di National Association of Medical and Dental Academics (NAMDA) for Abuja, di kontri capital.
CONUA and NAMDA na separate body of academic unions different from di Academic Staff Union of Universities (ASUU).
"Dem dey try to break di rank of ASUU by approving di two breakaway factions."
Na so one of Nigeria Labour Congress Senior Assistant General Secretary, Eustace Imoyera James, tell BBC Pidgin, as im react to goment decision to present di breakaway factions wit certificates of registration.
Di labour leader say dis na goment attempt to checkmate ASUU, to break di union rank for di strike wey dem don dey do since di last seven months wit no solution.
“Dis na clear sign of di goment try to play to di gallery [or do tins wey dem tink say na wetin pipo want] instead make dem address di issue wey dey ground -dem just dey funny.”

Minister of Labour and Employment, Chris Ngige, wey present di certificates for Abuja today, say di two new unions go exist side by side wit ASUU.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ngige add say di new associations go enjoy di same rights and privileged wey every oda academic union dey enjoy.
E no clear wetin dis go mean for all di struggle wey ASUU don dey struggle for many years to make higher education system work beta for di youths.
James believe say di registration of two oda unions wit hope say e go bend ASUU no mean anytin las las.
"E no go work.
To register union no mata how dem wan put am, no go stop di legitimate struggle of di pipo.”
Approval of breakaway factions
Nigeria goment present certificate of registration to di CONUA and NAMDA.
CONUA and NAMDA na separate body of academic unions different from di Academic Staff Union of Universities.
Di Minister of Labour and Employment present di certificates to di two unions for di Hon. Minister Conference Room, Federal Secretariat, for Abuja.
CONUA, na academic union wey dey only for few federal universities.
Im National Coordinator, na Niyi Sunmonu, wey be lecturer for Obafemi Awolowo University (OAU), Ile-Ife.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Wetin don dey happen wit ASUU
ASUU begin strike since 14 February 2022, and for August, di union declare “total and indefinite” continuation of dia strike.
Di union dey demand for academic autonomy, improved welfare for di lecturers and giving new life or revitalisation of public universities.
Although goment bin first agree to pay dem part of di money wey dem bin demand for di revitalisation of public universities wey be about N1.1 trillion, dem come say dem no get dat kain money now sake of low oil price.
As dem come dey try still find solution, na so di goment carry di union go court say make dem end di strike - meanwhile, as dis one bin dey occur, di goment say dem go do "no work, no pay".
Dis one mean say for di period wey di lecturers no work, dem no collect salary.
On 21 September, 2022, di National Industrial Court wey dey sit for Abuja, order make di Academic Staff Union of Universities (ASUU) end dia seven months old strike.
Di judge wey put eye for di mata Justice Polycarp Hamman restrain ASUU to kontinu wit di industrial action pending di determination of on substantive suit.
Im bin follow tok say di ruling dey for di interest of students.
“No amount of compensation fit cover for di loses of di students”.
ASUU come react say dem check wetin go be di best action for dem, but public universities across di kontri no fully open.












