You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin we know about di missing sub wey carri pipo go look di remains of Titanic inside di ocean
Di news say dem hear noise don give small hope say di five men on board di Titan submersible wey miss for sea dey alive.
Authorities dey on a search and rescue mission for one missing tourist sub wey carry pipo to see di Titanic ship wey bin sink many years ago.
Dem say di tourist sub miss for Atlantic ocean.
Tori be say small submersibles occasionally dey carry tourist and experts wey dey pay money to go look wetin remain of di Titanic.
OceanGate Expeditions, one private company wey dey deploy submersibles for deep sea expeditions, recently bin post for di social media feeds say one of dia expeditions bin dey "on dia way".
Di company dey charge guests $250,000 (£195,270) for a place for dia 8-day expedition to see di Titanic remains.
Dem say di trip on dia carbon-fibre submersible wey dem see as "chance to step outside of everyday life to discover sometin wey truly dey extraordinary".
Di Titanic dey, 3,800m (12,500ft) below di surface for di bottom of di Atlantic. E dey about 600km (370 miles) off di coast of Newfoundland, Canada.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di passenger liner, wey bin get di largest ship back den, bin hit one iceberg on dia first voyage from Southampton to New York in 1912. Out of di 2,200 passengers and crew onboard, more dan 1,500 die
Many pipo don see di Titanic since dem discover di ship wreck for 1985.
Wetin go happun next afta dem hear sounds for di search?
Na sonar buoys record di sounds for di ogbonge rescue operation, wey dey work round di clock to find di Titan for di middle of di Atlantic Ocean.
Dem loss for one deep-sea voyage to di Titanic wreck three days ago.
Dem relocate di underwater operations to investigate di noise dem, US Coast Guard tok, but so far dem neva find anytin.
And dem say di oxygen supplies dey expected to run out at around 11:00 GMT on Thursday, so di next few hours dey critical.
US authorities say di noise dem hear am at half hour intervals for about four hours on Tuesday, according to reports by several outlets.
Deep-sea experts wey BBC tok to say e dey hard to determine which kain noise e be without seeing di data.
But e dey possible dem fit dey short, sharp, relatively high frequency noises – wey dey come from within di vessel from hitting a hard object against di end of di sub.
Frank Owen, from di Submarine Institute of Australia, say im dey confident - based on di information available -say di sounds dey come from inside di vessel.
"If na 30-minute interval, e dey very unlikely to be anything but human related," e tell BBC.
Di men on board include British businessman Hamish Harding, 58, British-Pakistani businessman Shahzada Dawood, 48, im son Suleman, 18, and Stockton Rush, 61, di chief executive of OceanGate, wey dey run di voyages at a cost of $250,000 (£195,270) per head.
But Oga Owen say di noise dem wey im call "smack of advice" dey come from di fifth man on board - 77-year-old Paul-Henry Nargeolet, a former French navy diver and renowned explorer.
"Im go know di protocol for trying to alert searching forces… on di hour and half hour you gatz bang like no man business for three minutes," Oga Owen tok.
Di decision to relocate di search show say authorities dey think alike.
But for previous maritime searches - like those for missing Malaysian Airlines flight MH370 in 2014, and di Russian submarine Kursk for 2000 – Dem be hear underwater noise too, and e no give any results.
Di oda ray of hope na say dis sounds dey picked up by di sonar buoys, Oga tok.
Di Titanic dey 12,500ft (3,800m) beneath di ocean surface, wia di sonar buoys dey sit.
While sounds from deep ocean layers fit get through to dem, e dey more likely say di sounds dey come from di same ocean layer, Oga Owen tok.
Oga Owen say if di sounds true-true dey come from di sub, rescuers suppose dey able to locate am really quickly.
However, di underwater vehicles wey dem send to find di origin of di noise "don yield negative results", according to di US Coast Guard's latest update.
Who dey inside di sub?
58-year-old oga Hamish Harding, na one of di pipo wey dey onboard di Titan.
E be di chairman of aircraft firm Action Aviation e be popular explorer wey don fly go space. E also hold three Guinness World Records.
British businessman, Shahzada Dawood wey come from one of Pakistan richest families, dey also travel wit im son, Suleman, on di submarine.
Paul-Henry Nargeolet, na former French Navy diver, wey also dey on board.
Di 77-year-old na director of underwater research for one company wey get di rights to wetin remain of di Titanic.
Plenty reports dey say di Chief executive of OceanGate, Stockton Rush, also dey on di vessel.
Wetin else we know about di missing sub?
According to OceanGate website, one expedition dey on and two more bin dey planned for June 2024.
Di missing craft dey believed to be OceanGate Titan submersible, wey dey like di size of truck- di sub dey hold more dan five pipo and dey usually dive with a four-day supply of oxygen.
E no dey clear wen contact wit di craft lost.
But OceanGate say government agencies and odas dey help dem in di search.
"Our entire focus dey on di crewmembers for di submersible and dia families," OceanGate tok inside statement.
"We dey deeply thankful for di extensive assistance we don received from several government agencies and deep sea companies in our efforts to re-establish contact with di submersible," dem add.
Di submersible dey usually carry one pilot, three paying guests, and wetin di company call a "content expert".
A full dive to see di Titanic wreck, dey include di descent and ascent, wey dey take around eight hours according to reports.
Di OceanGate website list three submersibles wey dem get, and only di Titan dey capable of diving deep enough to reach di Titanic wreckage.
Di vessel dey weigh 10,432 kg (23,000 lbs) and, according to di website, fit reach depths of up to 4,000m and get 96 hours of life support available for a crew of five.
Di wreckage of di Titanic dey about 600km (370 miles) off the coast of Newfoundland, Canada.
Dem don explore am well-well since dem discover am in1985.
Di wreck dey in two parts, with di bow and di stern wey dey separated by about 800m (2,600ft). Di big remains of di Titanic surround di broken vessel.
Wetin be di Titan submersible?
- Di Titan na a five-person submersible, wey dey descend to depths of 4,000 metres
- Im dimensions na 670 cm x 280 cm x 250 cm
- E get "life support" of 96 hours for a crew of five
- E dey travel at three knots - wey be around 3.5 miles per hour
- Asides from taking divers to di remains of di Titanic, dem dey use am for site survey and inspection, research and data collection, film and media production, and deep sea testing of hardware and software
- E dey equipped with integrated platform wey di submarine dey launch from and dey return to before and afta each dive
Where di Titanic dey?
Di Titanic siddon for 3,800m (12,500ft) under di surface of di bottom of di Atlantic. E dey about 600km (370 miles) off di coast of Newfoundland, Canada.
Di passenger liner, wey be di largest ship of im time, hit one iceberg on im first journey from Southampton to New York for 1912. Out of di 2,200 passengers and crew onboard, more dan 1,500 die.
Dem don explore di Titanic well-well since dem discover im remains for 1985.
E lie in two parts, wit di and di stern wey dey separated by about 800m (2,600ft). One ogbonge field of di remains of di Titanic surround di broken vessel.