You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Hamas tok wen di four day break for dia fight wit Israel inside Gaza go begin
Reports for Middle East dey suggest say Israeli forces and Hamas go press pause for dia fighting from 10:00am local time (dat na 9:00am West Africa time), on Thursday.
Di deputy head of Hamas political bureau, Moussa Abu Marzouk, tell tori pipo Al Jazeera say dat na wen dem dey expect di pause to begin before dem go release di first hostages.
One Egypt security source tell tori pipo Reuters say di pause go start 10:00am on Thursday and Hamas bin want “few hours” afta e start before dem go begin free hostages.
One Israel Defence Ministry tok-tok pesin tell Reuters say di pause fit occur "sometime tomorrow".
Israel media dey say e go start around 7:30 West Africa time.
Reuters quote Israel Foreign Minister Eli Cohen wey say im dey expect im kontri to begin receive dia first hostage on Thursday - though im no gree confam di time.
Israel goment cabinet bin vote to approve hostage exchange agreement wit Hamas, afta more dan six weeks of ogbonge fight-fight for Gaza.
For statement, Israeli prime minister office say 50 hostages - women and children – na im Hamas go free inside four days.
During dis time, Israeli military actions for Gaza go slow down, di statement add.
For dia part, Hamas also release one statement wey tok say di 50 hostages go dey released in exchange for 150 Palestinian women and children wey also dey inside Israeli prisons.
Di agreement go also allow hundreds of trucks wey carry humanitarian aid, medical supplies and fuel to enta Gaza.
Dis go "reduce di suffering of innocent Palestinian families for Gaza," na so US President Joe Biden tok.
More dan 50?
Di Israeli goment say dem fit extend di ceasefire beyond di original period, adding say additional day go dey for evri ten hostage dem release.
Na important part of di agreement for families of di hostages, some of wey bin don tok say dem no wan see partial agreement.
"Di goment of Israel, di IDF (Israeli military forces) and di security service go continue di war to return all di hostages home, complete di elimination of Hamas and ensure say new threat no go dey to di State of Israel from Gaza," di statement from Netanyahu office tok.
Na around 230 hostages dey captive for Gaza, including foreign nationals from 26 kontris, according to Israeli military figures.
Na Hamas militants kidnap dem during dia attack on Israel on 7 October, wia some 1,200 pipo die.
Israel air and ground attacks on Gaza since dat date don leave more dan 11,000 dead, although di Palestinian territory Ministry of Health tok on Tuesday say some days ago, dem lost di ability to count di dead due to di destruction of di necessary infrastructure.
In recent days, tensions bin increase between di Israeli goment and families of di hostages wey dey Gaza, some of dem accuse di authorities say dem no dey do enough for Hamas to free dia pipo and dey use di kidnappings as reason to justify dia military campaign for Gaza.
United States involve
Joe Biden celebrate di agreement dis Tuesday, saying im dey "very happy" say some of di hostages wey don get to endure "weeks of captivity and experience wey dem no fit describe" go reunite wit dia families.
Barbara Plett, BBC correspondent for di United States Department of State, explain say di kontri involve well-well in achieving di agreement, wey Qatar and Egypt also follow chook mouth.
Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu imself credit Joe Biden wit improving di terms of di agreement, so e fit get "more hostages and fewer costs."
One senior US official say dem expect at least three US citizens, including one 3-year-old girl, to dey among di hostages wey dem go free in di coming days.
Wen e dey tok to tori pipo, e add say di girl, wey her name na Abigail, go turn four on Friday and say her parents follow for pipo wey die on di October 7 attacks by Hamas.
According to di official, Washington dey hope say di number of hostages wey dem go release "go pass 50, but I no wan give any figure."