How di governorship election go run for Lagos despite Oro palava

Lagos Govnorship candidates

Wia dis foto come from, Facebook/Instagram

Controversies still dey trail di restriction of movement for di Oro rites for Ikate-Elegushi kingdom, Eti-osa Local goment area of Lagos state.

Contrary to belief say di Oro na to affect di governorship election on Saturday, di Elegushi traditional council say no be true.

Dis na according to di Aro-Oba Elegushi, Chief Olalekan Bakare wey reveal dis one give BBC Pidgin.

Many for Lagos say di Oro wey dey follow di March 18 govnorship election bumper to bumper like dis be like e dey politically motivated.

Labour Party govnorship candidate for Lagos, Gbadebo Rhodes-Vivour echo dis thinking wen im tok for interview say, "e dey unfortunate say dis Oro rights dey seen as going in line with di Inec calendar wey make am look political".

E later enta social media to clear di air say, "Oba Elgushi don clear di air say, our festival no og affect Saturday election".

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Chief Bakare explain say, "Oro no dey dey on election day. E no dey affect election at all. Na also midnight to 5AM e dey hold so e no dey affect anybodi as di Oro dey end on Friday".

E add say, "Oro dey run for midnight, pipo go dey sleep, dem no go even know say anytin dey happun. We don dey do Oro regularly. Pipo just run wit dis tori becos of say na election.

"No bodi dey affected and security dey in force as long as women no dey outside within 12 midnight and 5AM, and as long as pipo make dem just respect our culture".

How di Election for March 18 go run

Di Independent National Electoral Commission release di timetable for di voting wey dey used for di procedure.

  • Voting dey start by 8:30am
  • Present your PVC for accreditation with BVAs
  • Check to make sure your name dey di register of voters for dat polling unit
  • Get authenticated with BVAs either with fingerprint or facials.
  • Once dem accredit you, you go get ballot paper
  • Enter voting cubicle vote in secret then you fit drop di ballot paper for ballot box
  • You fit comot or stay 300 meters away to see how dem dey count votes.

All voting suppose hold from 8:30am to 2:30pm but any pesin wey dey ques before 2pm go still fit vote.

Wetin be Oro?

Oro priest during di Oro festival for Ikorodu
Wetin we call dis foto, Oro priest during di Oro festival for Ikorodu

Oro festival na pure men affair for son of di soil alone and women, pikin dem plus visitors no suppose show face for road at all until di festival end.

As per tradition, evri time dem dey do Oro, no woman fit waka comot dia house.

Also woman must not look di men wey dey perform di rites, as dem dey waka from street to street.

Di belief na say any woman wey use eye see di men wey dey perform di Oro rituals go die - or something bad go happun to di woman.

Different towns for Yoruba land dey do Oro festival for different times for di year and each village get dia own way wey dem dey take do di celebration.

Oloye Kazeem Adeniyi Roga, wey be traditional leader for Ikorodu say di reason dem dey do rituals na to pray say evil spirit go comot from di community and to promote good tins to come to di pipo wey dey live dia.

Di main overnorship candidates for Lagos

Dr Azeez Olajide Adediran alias Jandor na journalist

Wia dis foto come from, Jandor/Facebook

Wetin we call dis foto, Dr Azeez Olajide Adediran alias Jandor

One of di candidates wey dey di race for di Lagos state gubernatorial election for Nigeria na Abdul-Azeez Olajide Adediran wey many pipo sabi as Jandor.

Dr Azeez Olajide Adediran alias Jandor na journalist, entrepreneur and politician.

Dem born am for 25 November 1977. Im papa na Muslim, while im mama na Christian. Dem born am for Mushin area of Lagos. E be di 5th child out of 7 siblings for im papa house.

Olajide come from Awori land for Ojo Local Government of Lagos State.

E get career for Communications Consultancy and e be di current Chairman and Group CEO of Core Media Group, one conglomerate wey get several oda companies wey include CoreTvNews.

In addition, e also be di chairmo of Datanet Project Services, one Oil Installation and Procurement services company.

Jandor do im primary school and secondary school education for Lagos. E attend di Polytechnic of Ibadan plus Universities wey include Modul University, Vienna, Howard University School of Business, Washington DC, USA and Oxford University, Oxford, United Kingdom.

During di PDP primaries, Jandor use 679 votes win im opponent David Vaughan wey get 20 votes.

E claim to be grassroot politician and say im don waka all di corners of Lagos and im sabi wetin di problem of di pipo be.

Jandor dey married to Mrs. Maryam Olajide Adediran and dem get children.

Babajide Sanwo-Olu na di 15th govnor of Lagos state

Wia dis foto come from, Lagos State government/Facebook

Wetin we call dis foto, Babajide Sanwo-Olu na di 15th govnor of Lagos state

Di govnor of Lagos state, Nigeria commercial capital dey hope to come back for a second term wen residents of di state go to di polls on Saturday, 11 March to vote for di 2023 govnorship election.

Govnor Babajide Sanwo-Olu wey be di 15th govnor of di state dey run on di platform of di All Progressives Congress to dey re-elected as govnor for a second term.

Babajide Sanwo-Olu na di 15th govnor of Lagos state, Nigeria commercial city.

Di kontri electoral body, di Independent Electoral Commission, Inec declare am winner of di March 9, 2019 gubernatorial elections afta e defeat 44 oda candidates wey represent different parties for di election.

Dem born oga Sanwo-Olu on June 25, 1965 for Lagos State. E start im early education for Lagos and Ogun state. For im higher education, e study for University of Lagos, wia e get Bachelor’s degree in Surveying & Geo-Informatics and Master of Business Administration (MBA) in Management from di same University.

E enta into public service afta e don spend many years for private sector, especially for di Nigerian banking sector, where e retire as General Manager.

Oga Sanwo-Olu also na alumnus of di prestigious Havard Kennedy School of Government, London Business School and di Lagos Business School. In addition, e be member of di Nigerian Institute of Directors (IOD), Chartered Institute of Personnel Management (CIPM), and Fellow of Nigeria Institute of Training and Development (NITAD).

Before e become govnor, e bin serve as Special Adviser to di Deputy Govnor on Corporate Matters; and later as Special Adviser to di Govnor on Corporate Matters for 2004.

For 2007, dem appoint am as Commissioner for Commerce and Industry.

E don serve for plenty public offices wia e don gada experiences wey dey help am for di governing of di state.

39-year-old Gbadebo Rhodes-Vivour na architect

Wia dis foto come from, Vivour-Rhodes/Facebook

Wetin we call dis foto, Arc Gbadebo Rhodes-Vivour

39-year-old Gbadebo Rhodes-Vivour na architect, public policy expert plus politician.

Dem born am for 8 March 1983 to di Rhodes-Vivour family of Lagos. According to am, e be proud Lagosian, as im root and antecedents na from Lagos state.

Gbadebo come from di family of accomplished legal luminaries. Im father, Justice Olawale Rhodes-Vivour na former Supreme Court of Nigeria justice.

Di late Judge Akinwunmi Rhodes-Vivour na im grandfather, e also be di great-grand son of Judge Steven Bankole Rhodes, di second ever indigenous judge Nigeria appoint.

Dem born Gbadebo for Lagos Island. E grow up and get im early years education for Lagos state before e travel go Paris, France for further studies.

For im university education, Gbadebo get B.Arch. from di University of Nottingham, e work for di architecture office of Franklin Ellis Architects, UK before e later go do im master’s degree from Massachusetts institute of technology (M.I.T), Boston, USA.

E come back Nigeria for im National Youth Service Corps (NYSC) duty for 2008-2009.

Sake of im interest for politics and activism, e go do im second Master’s degree in Research and Public Policy for di University of Lagos (UNILAG).

Funso Doherty

Wia dis foto come from, Funso Doherty/Instagram

Wetin we call dis foto, Funso Doherty na di Lagos govnorship candidate for di African Democratic Congress

Funso Doherty na di Lagos govnorship candidate for di African Democratic Congress.

Di 54 year old don work for Goldman, Sachs and Co. Investment management, bin work as di di first MD/CEO for ARM Pensions.

E bin also start wit GTBank as pioneer staff for dia investment management arm.

Funsho do all im schooling including University for Lagos, before im go run im Masters for Harvard Business School.

Im plans for Lagos if im win as govnor na to create public sector wey go dey based on merit and accountability with beta private sector.

All dis one na to build Lagos to be example of wetin im call “national transformation”, with beta quality of life and ogbonge hustle.