Nigeria secret service caution online platform X (Twitter), demand deactivation of Sowore account

Foto of Omoyele Sowore

Wia dis foto come from, Omoyele Sowore/Facebook

Read am in 3 mins

Nigeria secret service di Department of State Service (DSS) say make social media platform X (formerly twitter) comot Omoyele Sowore from di platform.

DSS request dey inside one strong letter dem write to X wey base for Texas USA.

For di letter wey dem publish online, DSS accuse Sowore, a publisher and politician say e dey spoil di name of Nigeria President Bola Tinubu.

Dem say im actions dey also spoil Nigeria image and dey give pipo wrong brand about di kontri.

"Di said tweet still dey in circulation and don attract widespread condemnation by majority of Nigerians," DSS tok for statement.

'Sowore comment na threat to national security' – DSS

DSS for di letter wey one official B. Bamigboye sign on behalf of di Director General of di agency, Adeola Oluwatosin Ajayi, say Sowore action na threat to national security.

Di agency also X, di platform wey di Nigerian politician take publish di post dey "criminally liable" according to di laws of Nigeria.

Dem say Sowore by dat post, violate sections of di Terrorism (Prevention and Prohibition) Act, 2022

"Said said tweet still dey in circulation and don attract widespread condemnation by majority of Nigerians, some wey go wan do unlawful tins to show dia anger, especially supporters of di President wey don start enta street to protest, thereby creating political tension and threaten di kontri national security.

Dem say di effect of dis tweet "spoil di reputation of Mr. President and di kontri before di comity of nations.

"Di author and purveyor of di inflammatory online publication against Mr President dey very much aware say di publication dey also prohibited by Section 2(3) of di Terrorism (Prevention and Prohibition) Act, 2022 and oda relevant Laws of di Federal Republic of Nigeria.

Who be Omoyele Sowore

Omoyele Sowore na journalist, human rights activist wey bin don follow contest for Nigeria presidential election.

E don collect plenti arrest and detention over di years.

Im be di RevolutionNow leader for Nigeria and Publisher of Sahara Reporters news platform.

Nigeria govment bin arrest Sowore for August 2, 2019 say im commit treason.

Dem later release am for 5 December afta e spend more dan 3 months for detention, only to re-arrest am inside court less dan 12 hours later.

On 13 December, 2019, Attorney General of Nigeria and Minister of Justice, Abubakar Malami bin take ova di case of Sowore from di country Department of State Service.

Den on December 24, DSS release di publisher afta oga Malami write to di DSS say make dem release am.