Who be dis Buhari new ministerial nominees, who dem go replace?

Buhari new ministers: Buhari send ministerial nominees to Senate

Wia dis foto come from, State House

President Muhammadu Buhari don send seven ministerial nominees to Nigerian Senate for confirmation.

Dis nominees go replace di ministers wey bin resign recently.

Dem bin leave di Federal Executive Council to go pursue dia political ambitions for 2023 general elections.

Nigeria electoral law require appointed goment officials to leave dia offices before participating in an election as candidates.

Buhari write di Senate on Tuesday wit di names of nominees.

Di list include di following:

1. Henry I. Ikoh - Abia

2. Umana Okon Umana - Akwa Ibom

3. Ekumankama J. Nkama- Ebonyi

4. Goodluck Nana Opiah - Imo

5. Umar Ibrahim El-Yakub - Kano

6. Ademola A. Adewole - Ondo

7. Odum Odi - Rivers

Who di nominees go replace

Buhari new ministers: Buhari send ministerial nominees to Senate

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Godswill Apkabio, Paulline Tallen , Chibuike Rotimi Amaechi, Ogbonaya Onu

In April and May dis year, some cabinet ministers declare intentions to be dia party candidates.

Dem become aspirants for either presidential or state govnorship elections wey dey hold next year.

Di only way pesin fit be candidate na to resign before di primaries.

Those wey bin resign include:

Chibuike Rotimi Amaechi - Minister of Transportation

Godswill Akpabio - Minister of Niger Delta Affairs

Ogbonnaya Onu - Minister of Labour and Employment

Emeka Nwajiuba - Minister of State for Education

Uche Ogar - Minister of State, Mines and Steel Development

Paulline Tallen - Minister of Women Affairs

One of di clause wey dem newly introduce for di new electoral act na section 84(12) wey provide dat anyone wey hold political office - ministers commissioners, special advisers and odas - must give up di position before dem go fit dey qualify to participate for di electoral process either as candidate or as delegate.

Offices di nominee go occupy if Senate confirm dem

When about six cabinet minister bin quit to face dia political ambition last month, at least six ministerial offices become vacant.

President Muhammadu Buhari goment still get at least 11 more months to go before e hand over to a new goment after next year election.

Need to fill up di vacant positions dey as e be say some key ministry ministers inside di cabinet bin resign.

Wen di Nigerian senate confirm dis nominees, each of dem go occupy di following federal ministariel offices

Minister of Transportation

Minister of Niger Delta Affairs

Minister of Women Affairs

Minister of Science and Technology

Minister of State for Education

Minister of State, Mines and Steel Development