Wetin we know about Taylor Swift new album - The Life of a Showgirl
- Author, Tabby Wilson
- Role, BBC News
- Author, Paul Glynn
- Role, Culture reporter
- Read am in 6 mins
Taylor Swift don announce her 12th studio album, The Life of a Showgirl, afta fans begin carry rumour about am in di last 24 hours.
Rumours begin fly on Monday morning, wen di marketing team of di singer bin post carousel of 12 foto wit di caption: "Thinking about wen she bin tok 'see you next era'."
For di hours wey bin follow, Swift official website bin start to countdown to 00:12 ET (05:12 BST), wen her boyfriend, NFL star Travis Kelce bin confam say she go be guest dis week for im podcast, New Heights.
Na Swift reveal di title of di album by herself ontop social media clip wey bin start before Kelce podcast, and dem make di record to dey available for pre-order on her website di same time.

Wia dis foto come from, PA
Fans wey bin pre-order di album receive message wey bin tok say dem go ship am before 13 October, but say "no be di release date be dat".
Dem neva confam di official date wey dem go release di new music.
Di 11th album of di pop star The Tortured Poets Department, wey dem release last year, bin break di Spotify record for di most-streamed album in one day.
Shift from di usual way?
To announce her new album for her current boyfriend podcast na veri interesting move for Swift, as much of her songwriting and back catalogue na about her previous relationships.
Tori pipo bin carry di news well-well - even though dem neva confam am - say her last album na detail of her break-up from The 1975 singer Matty Healy. Oda former partners wey include Harry Styles, Jake Gyllenhaal and John Mayer na pipo wey fans tink about for a veri long time say dem be subject of her songs before.
Di deputy music editor for di Guardian Laura Snapes, tell BBC Radio 4 Today programme on Tuesday say di subject of relationships fit comeback on di agenda.
"E get one leaked photograph of, allegedly, di inside of di vinyl wey dey go around wia you fit see some wey no too clear, out of focus lyrics," Snapes tok. "And e be like say na some stuff about love.
"Sometin fit dey about di situation wit her former label... e be like say she neva stop to sing about am."
Di star, she add say dey, "famously give no interviews". So evritin her fans hear from her "na direct" , either thru social media or comments wey she make on stage in between songs for her big gigs like during her all-conquering recent Eras tour.
New album just be like "an update on her life - wetin she bin dey tink of, wetin she bin dey feel", Snapes tok, di music editor add say e dey "really interesting" say Swift deliver di update like dis.
"E be like say e dey quite loose - way wey we no dey really get to see her in public," di journalist add.
"And I wonder if e go signal a shift for her media approach, or if na just her boyfriend podcast?"
Snapes say she go dey "watch wit interest" wen di full podcast go drop around 00:00 BST on Thursday.

Wia dis foto come from, Getty Images
Afta years of headlines during her record-breaking Eras tour, e be like say Swift get one-kain quiet start to 2025.
For May dis year, dem bin announce say she bin buy back di rights to her first six albums, wey end a long-running and highly publicised battle ova di ownership of her music.
Afta her original masters bin sell am, she bin vow to re-record all six albums, wey pipo kon sabi as "Taylor Version". To date, she don re-release four of di original six.
Swift bin announce say she don buy back her original masters wit one letter to fans wey melt pipo heart, wia she bin write say di final two albums "go get dia moments to come back wen di time dey right."

Di singer bin wrap up di Eras tour for December 2024, afta she play for 149 shows for 53 cities.
For UK alone, she play for almost 1.2 million pipo, including eight nights for Wembley Stadium. Di tour bin generate an estimated £1bn for di kontri economy, and na wetin make Swift to officially claim billionaire status.
Di star also get plenti awards, di American Music Awards bin name her artist of di decade, she be di most awarded artist of all time for MTV Video Music Awards and she don win 14 Grammy awards, including an unprecedented four album of di year awards.
How she take big like dis?
Her pandemic era albums Folklore and Evermore na significant turning point, according to BBC Culture correspondent Mark Savage, wit di indie-folk arrangements wey win ova critics and fans wey bin no dey impressed by her country and pop hits.
Di rise of TikTok introduce her to a new audience, while di ongoing project of re-recording her first six albums bring back her older hits to life.
"She be just one of those rare timeless artists wey dey get am right evritime," na wetin fellow pop star Raye tok last year. "She be complete powerhouse."
"She be fantastic role model," Scottish singer-songwriter KT Tunstall add.
"She get di resilience and di self-confidence to be di boss of ogbonge machine, wey dey employ thousands of pipo. To dey able to handle am and handle wetin dey come to her publicly, you just get to be a one-off."
Lana Del Rey, wey bin sing togeda wit Swift for di 2022 song Snow On The Beach, bin get anoda theory about di way di star dey dominate.
"She want am," di singer bin tell BBC News last year.
"She bin don tell me so many times say she want am more dan anyone. And how amazing - she dey get exactly wetin she want.
"She dey driven, and I tink say e dey really pay off."











