Why MK party sack South African politician wey visit controversial Malawian pastor

Wia dis foto come from, Gallo Images via Getty Images
- Author, Khanyisile Ngcobo
- Role, BBC News, Johannesburg
- Read am in 4 mins
Dem don sack Floyd Shivambu wey be top member for one of South Africa biggest political parties, afta e visit one controversial pastor for Malawi in April.
Shivambu na di secretary-general of di uMkhonto weSizwe (MK) party, but dem don remove am from office afta only six months sake of say e attend one Easter service for di church of self-proclaimed pastor Shepherd Bushiri for Malawi.
Oga Bushiri na very popular preacher for southern Africa, but authorities bin arrest am and charge am wit fraud for South Africa in 2020.
Afta dem release am on bail, e manage go im kontri Malawi and nobody know how e manage to escape. Since dat time, South Africa don dey try to extradite am even though di pastor deny di allegations.
Di MK party, wey former President Jacob Zuma bin form, tok for one press conference on Wednesday say dem remove Shivambu from office bicos im actions "dey against di spirit and prescripts of di MK party constitution".
"Di president and national officials no get anoda option but to act fast-fast," one MK official Nathi Nhleko tok.
E add say dat trip to Malawi "bin no dey officially sanctioned by di organisation".
However, oga Shivambu go remain member of di party and go now dey represent MK for di National Assembly.
End of Di one wey oda users dey read well well
Reacting to di news of im demotion, Shivambu say e "fully accept" di decision wey di party take and e dey look forward to taking up im new role for parliament.
Oga Shivambu bin join di MK party for August last year from di rival Economic Freedom Fighters (EFF) and dem later appoint am as dia secretary-general, wey be one of big positions for di party.
Under di leadership of former President Jacob Zuma, di newly formed MK party bin come third for last year elections, and dis na di major reason why di ruling ANC bin lose dia majority for di first time since democratic elections bin start in South Africa in 1994.
Who be Floyd Shivambu?
42-year old Floyd Shivambu come from Mahonisi, Malamulele town for di Limpopo province South Africa.
E study Political Science and International relations for di University of the Witwatersrand for Johannesburg, and na dia im political carrer start wen e win election as president of di university Student Representative Body and also join di youth wing of di ruling African National Congress (ANC). E remain strong member of di ANC until 2012.
Shivambu follow for di founders of di Economic Freedom Fighters (EFF) in 2013, togeda wit Julius Malema and e serve as di Deputy President of di party until 2024
E bin also serve as di lieutenant commander-in-chief of di party and also as di Parliamentary Chief Whip of di EFF for di South African parliament.
For inside di parliament, Shivambu bin work for di Trade and Industry Portfolio Committee and Standing Committee on Finance.
E also belong to di Pan African Parliament wia e serve for di Rural Economy, Agriculture, Natural Resources and Environment Committee.
But e leave di EFF on 15 August 2024 to join di uMkhonto weSizwe (MK) wey President Jacob Zuma bin start.













