Why some house owners no dey give dia house to single women?

Wetin we call dis Video, Some Nigerian women follow BBC News Pidgin tok on wetin dia eyes see wen dem dey find apartment for di kontri.
Why some house owners no dey give dia house to single women?

Some Nigerian women wey experience discrimination wen dem dey find house for di kontri as single women follow BBC Pidgin yan about wetin dem face.

Di ladies outline di challenges wey dem dey face wey make am difficult for dem to fit rent.

“I dey veri frustrated oh honestly, I dey very frustrated, in fact I kon dey reason say which kain discrimination be dis? One of di women Bolu tok.

One landlady - Alhaja Aliyu Zainab also follow BBC Pidgin tok on why she no dey like give her house to women and on what condition she fit give.

Video by: Tunde Ososanya, Monday Idara and Mobolaji Olatunde

Collage of some of di women