Who fit be Kamala Harris running mate?

Newsom, Whitmer and Buttigieg

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Newsom, Whitmer and Buttigieg
    • Author, Ana Faguy & Madeline Halpert
    • Role, BBC News
  • Read am in 5 mins

US President Joe Biden on Sunday announce say e go end im re-election campaign, and tok say Kamala Harris, im vice-president, go take im place.

"I wan offer my full support and endorsement for Kamala to be nominee of our party dis year," e write on X. "Democrats — na time to come togeda and beat Trump."

A Ms Harris take over look likely, although no be done deal.

Some oda pipo name don drop as potential replacements for Oga Biden but Biden don back Ms Harris. If di endorsement become official, one running mate go dey needed.

Delegates go vote next month for di Democratic National Convention to officially confam who go replace Oga Biden, and di candidate for vice-president.

Di following names fit dey di mix.

Michigan Governor Gretchen Whitmer

Michigan Governor Gretchen Whitmer

Wia dis foto come from, Getty Images

Gretchen Whitmer, di two-term governor of Michigan, na one popular Midwest Democrat wey many pundits dey tok say go run for president for 2028.

She bin don campaign for oga Biden for di past and no dey shame about her political aspirations.

She bin tell Di New York Times say she wan see one Generation X president for 2028, but she no suggest say she fit fill dat role.

For 2022, she bin lead one campaign wey leave Michigan Democrats for control of di state legislature and di govnor mansion.

Dat one bin allow her to make some progressive policies, including protecting Michigan abortion access and passage of gun safety measures.

Ms Whitmer bin quickly tok afta Oga Biden withdrawal say her job "go remain di same... do everytin wey I fit to elect Democrats and stop Donald Trump".

California Governor Gavin Newsom

California Governor Gavin Newsom

Wia dis foto come from, Getty Images

California govnor na one of di Biden administration strongest surrogates.

Dem dey sometimes list am as di possible 2028 candidate, but many Democratic sabi pipo don suggest say e fit dey di race to replace Oga Biden.

Oga Newsom bin raise im national profile for recent years as e be key party messenger on conservative media, and through one debate against Florida Governor Ron DeSantis last year.

E bin tanda by di president bifor im announcement. E bin travel to Washington to attend meetings for July wit Oga Biden and oda top Democratic govnors, and headline one Biden campaign event for Michigan for 4 July.

Oga Newsom again bin praise Oga Biden as a "selfless" president afta im withdrawal, and tok say e bin back di "fearless" and "powerful" Ms Harris to face Trump.

Transportation Secretary Pete Buttigieg

Pete Buttigieg siddon for front of microphone

Wia dis foto come from, Getty Images

No be secret say Pete Buttigieg get presidential aspirations.

E bin run for 2020 and most times dem dey describe am as one of di Biden administration best communicators.

Oga Buttigieg don manage some number of public crises during im time as transportation secretary.

E bin help to oversee di goment response to di East Palestine train derailment for Ohio, di Baltimore Bridge collapse and Southwest Airlines scheduling crisis for 2022.

Oga Buttigieg bin tok on Twitter/X say Oga Biden don "earn im place among di best and most consequential presidents for American history".

E tok say e go do "all wey I fit to help elect Kamala Harris di next President".

Josh Shapiro, Pennsylvania Govnor

Pennsylvania Governor Josh Shapiro

Wia dis foto come from, Getty Images

Josh Shapiro don see high approval ratings since e dey elected for 2022 for one swing state Trump narrowly carry for 2016.

Di govnor, wey bin serve as di state attorney general bifor, don work across party lines during im tenure.

E bin make national headlines last year afta e quickly rebuild one collapsed bridge for one key Philadelphia highway - one major political victory for any first-term govnor.

Di quick-quick repair dey hailed by many as di perfect infrastructure talking point for one potential 2028 presidential candidate.

Oga Shapiro tok say Oga Biden na one of di "most consequential presidents for modern history" and go "do everytin I fit to help elect Kamala Harris as di 47th President of di United States".

JB Pritzker, Illinois Govnor

Illinois Govnor JB Pritzker

Wia dis foto come from, Getty Images

JB Pritzker, di govnor of Illinois, don raise im profile for recent years as e bin go afta Trump and dey defend Oga Biden.

Di billionaire businessman - wey be heir to di Hyatt hotel chain - dey quick post criticism of Trump for social media.

Afta di debate e bin call Trump "liar" and tok say e be "34-count convict felon wey care only about imself".

Like Ms Whitmer, Oga Pritzker get a track record to dey complete agenda items on progressive Democrats' to-do lists for issues like abortion rights and gun control.

E bin tok say oga Biden bin run "one of di most accomplished and effective presidencies of our lifetime".

Other possible candidates?

Di list of potential nominees to di ticket stretch beyond dis Democrats, as di party don develop a deep bench of talent.

Kentucky Govnor Andy Beshear, one two-term Democratic govnor for one very conservative state, don earn national attention since re-election last year.

Maryland Governor Wes Moore bin find imself for di spotlight for recent months following di collapse of di Francis Scott Key Bridge for Baltimore.

Senators Amy Klobuchar and Cory Booker don run for president for di past and bin get some name recognition among Democrats.

Georgia Senator Raphael Warnock, wey bin win one closely contested Senate race for one swing state.

And Arizona Senator Mark Kelly na anoda name under discussion. Na former US Navy pilot and astronaut wey bin win im senatorial seat for one key swing state.