Douye Diri win Bayelsa govnorship election

Di Independent National Electioral Commission (Inec) don announce Douye Diri as di winner of di 2023 Bayelsa state governorship election

Di Peoples Democratic Party candidate bin get im second term in office wit 175,196 votes.

Dat mean say e win with 60.93% of di votes.

Douye Diri beat 15 oda canditates wey include di former govnor of di state, di All Progressives Congress candidate, Timipre Silva and Labour Party Candidate Udengs Eradiri.

Bayelsa state pipo bin go vote on Saturday for who go lead dem for di next four years.

Bayelsa State Returning Officer Prof Farouk Kuta, Vice Chancellor of Federal University of Technology, Minna begin announce result around 10:00am on Sunday.

Before di collation bin commence, BBC Pidgin monitor situation outside di state collation center wia supporters of di PDP carry protest come INEC headquarters for Yenagoa to protest say some alleged supporters of APC no allow dem participate for di elections for Nembe- Bassambiri.

Na 16 candidates and political parties dey contest di govnorship election for wey happun on Saturday 11 November 2023.

Di State Govnor, Sen Douye Diri of di Peoples Democratic Party, PDP, dey seek re-election and go face oda candidates including Timipre Sylva of di All Progressives Congress, APC, and Udengs Eradiri of Labour Party, LP wey be youth leader from di state.

Na di Independent National Electoral Commission, INEC, go declare who win.

For govnorship election, di candidate wit di highest number of cast votes na im dem go declare winner – na di Returning officer of Inec go make di declaration.

According to di Electoral Act, di candidate must also get more dan one-quarter of di votes cast in at least two-third of each local goment area of di state.

Move around di map to see di results local goment by local goment as Inec dey declare am